Advertisement

Wednesday, November 13, 2024

Pidgin Post - OBO Say E Don Dey Old

Una special Musician Davido say him on dey old and he post am for that side wey dem dey call Instagram story.....He gree well well and explain say if na before when dey go for gigs or show, say as soon as dem land, him and him people go head to club to go enjoy and dem no care the time or wetin anybody talk but say these days eh, once him land, na sleep him just wan go sleep *Side eyes*
This explanation na one kind oyibo the omo baba olowo use talk am and and he even mention that gbenshing word wey start with F and end with K and as e dey talk e dey lick mouth like who dey lick licky licky..lol



24 comments:

  1. ''Like who dey lick licky licky'' Kai, no be small licky licky..lol

    ReplyDelete
  2. Davido,papa ejima,carry go.😍

    ReplyDelete
  3. The richest celebrity alive 💯

    Fan Emmanuel

    ReplyDelete
  4. Stella sef use style get bad mouth, see the way she finished OBO

    ReplyDelete
  5. Stella oooo🤣🤣
    Enjoy Omo Baba olowo

    ReplyDelete
  6. Stella na FC na.. leave am

    ReplyDelete
  7. David not only you Sha... everyone do dey old

    ReplyDelete
  8. The guy don try for that side.
    All those women, both old and young.😁

    ReplyDelete
  9. Papa Ejima aa Zukwanike, sure old age must be coming e no easy
    But you go still dey do lick lick nah 😜

    ReplyDelete
  10. Stella you too funny aswear 🤣🤣 biko leave my own OBO

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141