Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - No Gree For Anybody...

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Tuesday, January 09, 2024

Pidgin Post - No Gree For Anybody...

 This ''No gree for anybody this year'' slogan don dey cause wahala for many places eeeeeh. Some people don dey over react to the word and some no too understand am and dem don add gra gra put..

 

Na God i wan use beg una, say make una no let anybody around una overdo the thing oh...I watch video wey person slap soldier and e come dey shout say e no go gree for oppression this year......

Abeg no follow them them oh and epp me explain to people say the word no mean to fight or drag person for shirt.....

Anything wey you no go gree for this year, make e be poverty and ignorance and to dey worship pastor instead of God.....

22 comments:

  1. 🀣🀣🀣them dey tell man!

    Akpukpa aru ka nti anuife.😁

    ReplyDelete
  2. I no gree for any form of negativity,
    laziness and unproductive relationships...

    ReplyDelete
  3. You talk beta. No gree for anybody no mean say you go come dey zuzu

    ReplyDelete
  4. Lol @ to worship pastor or men or women of God lol
    The most complex B

    ReplyDelete
  5. No gree for anybody don make landlord comot tenant for house

    ReplyDelete
  6. I no gree for poverty this year.

    ReplyDelete
  7. I no go gree for procrastination this year. On the move. May God help me get better

    ReplyDelete
    Replies
    1. I no go gree for PROCRASTINATION THIS 2024

      Delete
    2. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ€£

      Licious babe

      Delete
  8. Hmmm.. no gree for anybody na him yesterday evening young man wey senior DSS official come to see unto say talk comot say the young man dey wan sexually assault 12 year old girl become another thing o. The guy resist arrest tell the DSS guy to do him worst say him no dey move anywhere.

    O boy, DSS tear the guy slap the guy return am o my people. Gbas! Gbos! No be small DSS guy o. Na person wey get better rank. When the DSS oga boys see say them slap their oga, my people see beating! Dem beat this guy, dem beat am as if dem dey pound akpu. Still the boy still dey make mouth o. These DSS guys beat sotey them tire. The boy no gree go anywhere. Na so DSS waka leave am.

    ReplyDelete
    Replies
    1. This your story is funny to me🀣🀣🀣🀣. Yes oh, we no go gree for anybody this year oh πŸ€£πŸ€£πŸ˜‚

      Delete
    2. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

      Delete
  9. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚.... make una easy ohh

    ReplyDelete
  10. I no gree for negativity this year o

    ReplyDelete
    Replies
    1. Chika(hello iya boys)9 January 2024 at 18:25

      Anybody that like should go and do pass him/her
      In the Name Of No gree for anybody..

      Delete
  11. I no gree for poverty this year.

    ReplyDelete
  12. Beta advice SDK,No gree for failure and immorality

    ReplyDelete
  13. No gree for anybody no mean say if anybody toast make you no gree oo
    The most complex B

    ReplyDelete
  14. 🀣🀣🀣 the slogan don tire me

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141