Stella Dimoko Korkus.com: The Hustle Post...

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Wednesday, December 06, 2023

The Hustle Post...

 Hustle Ooooo make them no say you dey kiss Stella bum if you say Hellooooooo....


Hustle ooo, make you no go visit your friend and dem turn you to servant...

54 comments:

  1. Hustle oh make dem no use ur pikin do UNICEF advert

    ReplyDelete
    Replies
    1. Hustle oh make usher no dey wake you up for church 😭😹

      Hustle oh make you no dey enter public bus jam your wife oh husband inside without knowing say na the same bus una enter oh.😭😹
      Hustle oh make your landlord no dey threaten to leave him house because you no pay rent on time

      Delete
  2. Hustle o, make dem no see your calls begin dey say wetin this one want again.

    ReplyDelete
  3. Hustle so you no go turn to server for family party.

    ReplyDelete
  4. Hustle o make you no use adieu papa/mama polo take do singlet 😃😂

    ReplyDelete
  5. Hf_beddings/fiber-pillows/honey/English-fabrics IG: hf_emporium_ 090723003916 December 2023 at 14:39

    Hustle ooo make you no become an errand girl amongst your mate ooo.

    Hustle ooo make you as a husband no go dey drink for Umunna (extended family) meeting and your wife go dey serve food.

    Hustle ooo make you no call girls wey dey wear hair of 500k foolish and worldly people with no values. Lol.

    Hustle ooo make you no say people that eat in push restaurants don't have home training and can't make good wives. Lol.
    Hustle ooo make u no think say you go first single lady with a ride marry
    Or she can't find a good husband .
    since she owns a ride, men will be running from her. Lol

    ReplyDelete
  6. Hustle oooo,make blog visitors no say na giveaway bring you out from your silent mode 🤣🤣

    ReplyDelete
  7. Hustle o make dem no talk on top your voice for village meeting o

    ReplyDelete
  8. Hustle ooo, make you no go become errand boy/girl for small pikin wey you fit born.

    ReplyDelete
  9. Hustle ooo make you no go dey monitor when Stella will do Santa post

    ReplyDelete
    Replies
    1. SMB is on a roll😂

      Delete
    2. 😂🤣😹
      I haven't experienced that before though

      Delete
    3. Fidel but na true nah

      Kisses to your little Angel 💞💕💖 and prince Andre.

      Lol Milkshakes

      Delete
  10. Hustle ooo make blog visitors no say you have collected giveaway 3 times

    ReplyDelete
    Replies
    1. 🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣

      Delete
  11. Hustle o,make dem no tell you to clean chair and open drinks during family meeting.

    ReplyDelete
  12. Hustle ooo make giveaway no disgrace you for Stella's blog.

    ReplyDelete
    Replies
    1. 🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣

      Delete
  13. Hustle o make you no go buy oversized slippers for pikin say he go grow meet am

    Mamannukusdkblogceleb

    ReplyDelete
  14. Hustle make ur church unit members no see you finish

    ReplyDelete
  15. Hustle ooo, make you no call for phone and dem go dey busy or ignore your call.

    ReplyDelete
  16. Hustle ooo make them no dey attack your comments say na for Giveway ooo.

    ReplyDelete
  17. Hustle oo..
    Make you nor always dey celebrities dm for begging oo.

    ReplyDelete
  18. Hustle ooo make you no turn to caterer for family get together when others dey ball.

    ReplyDelete
  19. Hustle oh..
    Make you no dey change gender from man to woman for agbado blog😌😌

    ReplyDelete
  20. lol at Stella's second post...my 23 yo daughter still wears her pry school pe shorts....jokes that they are her comfort blanket

    ReplyDelete
  21. Hustle o make you no go be tenant in your sixties.

    ReplyDelete
  22. Hustle ooh make you no tell your friend say you wan visit am, em go tell you say em dey travel

    Hustle ooh make Rich relatives no come give other Rich relatives expensive clothes to sew for burial ceremony and also give them polo but come give you only Mama jee nke oma polo to wear for the same burial

    Hustle ooh make your pikin no come dey cry because of hunger at the presence of a visitor and you go dey ask am wetin dey doam, dey form ignorance but you know say na hunger dey wayaram

    ReplyDelete
    Replies
    1. 🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣

      Delete
  23. Hussle oo make them no call you MPA AMAKA instead of DADDY AMAKA.


    Merryment

    ReplyDelete
  24. Hustle ooo, make your younger ones dey give una respect when you meet for function and not yimu behind your back

    ReplyDelete
  25. Hustle oooo make they no turn you to bottle picker for occasion for village meeting this Christmas..

    ReplyDelete
  26. Hustle ooh make u no go turn motivational speaker because of give away,
    Hustle make u nor go dey do sir sir for ur Junior or mate

    ReplyDelete
  27. Hustle o! Make you no shame your wife leave you because you dey prostrate for a pikin you fit born.

    ReplyDelete
  28. Hustle oh, make you no dey recieve insults everyday because you no get work

    ReplyDelete
  29. Wow of recent I have been having flashes of precognition. I thought about this hustle post and how long ago it has been featured, Taraaaa 💃here it is

    Hustle o, so that you no go becos of giveaway no talk true when you am.

    Hustle o, so that you no go begin do by force feferity for BV(S) wey u no even like, because you feel say e go boost your chances to be given giveaway

    Hustle o, so you can enjoy SDK' s blog for the fun blog it is uninhibited, because you are always stategising to receive giveaway

    ReplyDelete
  30. Hustle ooh make dem no insult you for anonymous mode say "you don collect mula, now na two sentence comment you dey make"

    ReplyDelete
    Replies
    1. Please where did the excitement happen? LMAOOOO. I missed.

      Delete
  31. Hustle o,make u no call kaikai vodka

    ReplyDelete
  32. Hustle o, make your in-laws no use you as nanny for family party

    ReplyDelete
  33. Hustle o, make dem no dey give you 1000 for bike instead of 10000 for fuel

    ReplyDelete
  34. Hustle o, make your children fit attend the school where your wife dey work

    ReplyDelete
  35. Hustle o, make you no tell your children say Father Christmas na one Yoruba man dey inside (so you won't take them to see him as money no dey)

    ReplyDelete
  36. Hustle oo, make you no serve your siblings because of money

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141