Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Some People Too Get Sense!

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Sunday, October 08, 2023

Pidgin Post - Some People Too Get Sense!

 Afrobeat singer Seun Kuti don make me laugh tire when i read wetin e talk...


You know dem been lock for jail that time when e get kwanta with Police ? Well as dem release am, he say he send money give Police make dem use repair the jail wey dem been lock am put and make everywhere neat and fine because tomorrow dem fit lock am there again..

E come add the one wey go burst your brain, E say em colleague Naira Marley wey dem hold for there now go enjoy the place as him don renovate am...

Na wah, na Naija people dey renovate prison abi na govament? I confuse!
Anyway e good as Seun repair the prison cos em mouth too sharp and nobody sabi tomorrow....

8 comments:

  1. 😂😂😂😂😂😂😂😂
    Seun and his mouth sha

    ReplyDelete
  2. Chika(hello iya boys)8 October 2023 at 16:00

    Lmao 😂😂😂😂 chaii
    If them go Repair am be that ooo..
    We know as Niger things dey be o ooo🤣🤣

    ReplyDelete
  3. Lol 😆
    Orishirishi for naija

    ReplyDelete
  4. Abi oh! That is if them go repair am

    ReplyDelete
  5. Baba know say im fit still go back there nah 🤣🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  6. 😂😂😂


    Neesolah

    ReplyDelete
  7. Na Police custody (cell) dem hold Seun dat time, no be prison .

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141