Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Lawyer Wey No Go School Plenty

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Saturday, October 14, 2023

Pidgin Post - Lawyer Wey No Go School Plenty

 You don hear the news wey Africa facts zone drop? Dem say for Kenya e get one man wey em name be Brian wey be Lawyer wey dem arrest because e be fake....E be fake mean say e no attend the University and the Law school but make i shock you? Dem say all the 26 cases when e go argue for court before dem catch am e win all!!...E shock you? E Shock me !!


For your Country (fear no let me mention the country) even the one wey go the University and the Law school sef no dey fit talk for court, na to dey fight drag chair and table dem sabi..... 

If you ask me eh, Lawyers don too plenty sef and some of them no see work, so if person do Lawyer work and no waste time go school, e no bad na.

Infact Lawyers wey no go school plenty na...dem even full Internet and this Blog and anytime controversy land, nah dey for front dey yarn things wey make sense pass Lawyer wey go school sef...

Some Lawyers sef if dem handle your matter wey no serious before, you go lose because dem no carry annointing..

How you see am?

9 comments:

  1. Law is one strange industry. I know someone who did one year of law school and quit and went to med school instead.

    ReplyDelete
  2. Lawyer is now buy 1 get 1. You can even study law from the comfort of your home. If some Nigerian lawyers draw contract for you, na you self go dey shame for them

    ReplyDelete
    Replies
    1. Hmmm.
      The Law School graduated some 1,000+ a while ago.

      Ste... your second to last paragraph.
      Dey find trouble. Continue.

      Delete
  3. That man go really be beta lawyer if he clam down and read book.

    ReplyDelete
  4. 😂😂😂 e shock me o but the man na genius sha.

    ReplyDelete
  5. These matter serious no be small, make you go see how Lawyers dey suffer for Abuja, Omo no be small

    ReplyDelete
  6. I have a classmate in secondary school then, he went into clearing and forwarding after we finished secondary school, the next time I saw him the guy come dey form Barrister kini.. Lolzzz. I laughed and asked some few friends and they said he dey impersonate. Later someone advised him to go back to school and as God will have it he is a professional lawyer today.... Lolzzz.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141