Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Double Wahala To Repay Honest Man

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Saturday, September 23, 2023

Pidgin Post - Double Wahala To Repay Honest Man

One wey man dey live for Kano wey dey drive Keke to use survive, come see say one of him customer forget N15 million and some other currency for him Keke, na so he run find the person, come return the money... Dem say e no collect ten kobo inside am (Side eyes at you wey for collect all if to say na you find the money).
He receive plenty gifts, and dem even dash am new keke but the thing wey dey shocking pass be say. dem say dem wan dash am four new wives to marry becos he nah good man. For that side plenty wives nah riches.
How you see am? You for return the money?
 

10 comments:

  1. na to dey churn out potential almajiri

    ReplyDelete
  2. Na kill dey wan kill d man.

    ReplyDelete
  3. Who plenty wife help for this away kontri now? Make them dash am four new Keke instead of four wives. That one go pay the guy pass.

    ReplyDelete
  4. I go return the money if I know the owner, but if I no know the owner, walahi talahi I no go fit go police station go report wetin dem no loss, I no trust dem chacha.
    Yeye pipu, so na women be di man problem abi, if one check well now the so-called women sef fit be underage.

    ReplyDelete
  5. The guy even said all the money people said they donated to him, he didnt see any, just only that N400,000 reward in his hand. He has not seen the rest and they are planning on sending 4 poverty pro max to him.
    Boy run

    Mao Akuh

    ReplyDelete
  6. This one na double wahala promax.

    ReplyDelete
  7. In this kind time it takes high integrity and fear of God to do such a thing like this. Kudos.
    As for marrying 5wives, na dem sabi

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141