Stella Dimoko Korkus.com: The Hustle Post

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, August 07, 2023

The Hustle Post

E get why you suppose hustle...
Hustlemake dem no use your teeth do opener for family meeting....
Hustle make you no use Newspapers as pampers for your pikin...

 



 

132 comments:

  1. Hustle o make dem no use your everyday brand T-shirt as rags

    ReplyDelete
    Replies
    1. Hustle o make children no dey hide their cheese balls wen dem see you.

      Delete
    2. lol. the aunty that used to finish our cheese balls is coming o

      Delete
  2. Hustle O make small pikin no run from you o say ''That Uncle Beggy Beggy don dey come''

    ReplyDelete
    Replies
    1. Hustle o make your shildren no go all those schools wey dem dey draw giraffe and cats on their walls.
      E go come dey write I am as Am. Been as being and Sell as sale.

      Delete
    2. XP I am howling with laughter

      Isi gini?😂😂😂😂😂😂😂😂

      Delete
    3. XP 🤣🤣🤣🤣🤣🤣😂😂

      Delete
    4. Thinking of it now, it's true o @XP. Most big schools in my city here, nothing on their walls except the name of the schools. It's mostly all those iya moimoi private schools that draw stuff on their walls outside and inside

      Delete
  3. Hustle o make your neighbour no recognize your branded Indo-mie or Dangote Salt T-shirt before them see your face...

    ReplyDelete
    Replies
    1. Hustle o make dem no dey tell you for owambe and other real parties say "aunty, rice dey but meat don finish o,no vex"

      Delete
  4. Hustle O make your neighbours no talk say ''Uncle Bernard dey house e go pack my cloth from line''

    Uncle Bernard go helep us pay Nepa bill...

    ReplyDelete
    Replies
    1. Hustle o make dem no dey ask you to tell them wetin time dey talk for your phone because dem know say your wristwatch no dey work.

      Delete
  5. Hustle make you no come dey defend community 🥒 for your children's inheritance like Bee Aee
    The most complex B

    ReplyDelete
    Replies
    1. Hustle o make you no come dey beg your rich relatives make your shildren come holiday for dem house because you no get food for house.

      Delete
  6. Hustle O make you no play football with small pikin. You do wrong pass. Boys go say ''I tell una say make we no allow this Uncle play e no get sense''

    ReplyDelete
  7. Hustle o!! Make dem no caption you ...'and others' for picture. 🤣

    ReplyDelete
  8. Hustle O make your neighbour no say '' No worry Uncle Bernard go wear Tiger spice T-shirt tomorrow then him go wear Airtel T-shirt on Wednesday''

    ReplyDelete
  9. Hustle oh make your neighbour no drive pass you still splash potopoto for your body like them do me yesterday

    ReplyDelete
  10. Hustle o! Make Uber/Bolt drive no tell you say you no fit sit for back.

    ReplyDelete
  11. Hustle oh make you no turn to clothes packer for your neighbours when rain fail cos e go look somehow say you dey house,rain still come fall wet their clothes as dem no dey house.

    ReplyDelete
  12. Hustle oo, make your friend no see your call begin say "wetin de worry this idiot sef? I know say im wan beg me for money again".

    ReplyDelete
    Replies
    1. 🤣🤣🤣🤣
      Hustle o make dem no hiss when they see your call and cut it off

      Delete
  13. Hustle oh, make your younger ones to threaten to troway your load outside because you correct them.


    I am in pains, mehn.

    ReplyDelete
  14. Lol! Hustle ohhhh! Make your pikin no vomit Garri for class 🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  15. Hustle o, make dem stop to dey give you IV one day before event!

    ReplyDelete
    Replies
    1. Hustle o make dem no dey dash you N5k to go dey abuse strangers you no sabi their house online.

      Delete
  16. Hustle O make your friends no see as person wey go dey snap picture for them, you no dey appear for picture at all at all

    ReplyDelete
  17. Hustle O Make your happy new month message no make your friend no say ''Amara don't worry I will send the 5k to you''

    ReplyDelete
  18. Hustle oòoo make they no turn you to bottle picker for family meeting..

    ReplyDelete
  19. Hustle oooo make nobody day hiss when they see your call..

    ReplyDelete
    Replies
    1. Hustle o make dem no turn you to photographer during school alumni group photo.

      Delete
  20. Hustle o so that people will sharpaly pick ur call,make dem no see ur call, come say,this one na beg dey make her call

    Ada ohafia

    ReplyDelete
  21. Hustle o make creditors no dey pursue left right center, even for your dream

    Hustle o make you no dey fear to pick your calls

    ReplyDelete
  22. Hustle o make you no dey daydream say person dash you money

    ReplyDelete
  23. hustle oh make you no go marry
    anyhow person because of greencard

    ReplyDelete
  24. Hustle o make your friends no put you in charge of plate packing during their ceremony.

    ReplyDelete
  25. Hustle O make you no turn charity case

    ReplyDelete
  26. Hustle o make bvs no yab you when them select you for giveaway

    ReplyDelete
  27. Hustle make you no enter anonymous mode dey ask for waju contact make them select you for data giveaway

    ReplyDelete
    Replies
    1. 😂😂😂
      Weti bring all this vawulence this hot afternoon na??

      Delete
  28. Hustle o make jealousy kee your haters/enemies

    ReplyDelete
  29. Hustle o so ndi uchu and achikota ekwe onussss will repent, tap and give God the glory on your behalf🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  30. Hustle o so you no go dey waka round market were you dey price

    ReplyDelete
  31. Hustle o so you no go go cut yam for market

    ReplyDelete
  32. Hustle so you fit sleep well for night

    ReplyDelete
  33. Hustle oooo make you no post for SDK say you no subscribe your gotv because of BBN meanwhile na money you no get to subscribe am.

    ReplyDelete
  34. In all hustle o.

    E get why...

    ReplyDelete
  35. Hustle o make God use you bless others

    ReplyDelete
  36. TASTE BLISS CAKES AND PASTRIES7 August 2023 at 14:23

    Hustle ooo make your teeth no serve as opener for family meeting,

    Hustle oooo make you no talk say NTA na your favorite channel.

    ReplyDelete
  37. TASTE BLISS CAKES AND PASTRIES7 August 2023 at 14:25

    Hustle ooo make you no download I phone ringing tone for your android phone.

    ReplyDelete
  38. Hustle o, make you no carry wetin senior your mama marry because you wan travel.

    ReplyDelete
  39. TASTE BLISS CAKES AND PASTRIES7 August 2023 at 14:28

    My brother hustle oooo make dey no give MC your name for occasion, he go hiss, squeeze the paper for him pocket and call another person name.

    ReplyDelete
  40. TASTE BLISS CAKES AND PASTRIES7 August 2023 at 14:28

    Hustle oooo make Pretty Mike no cook your father inside pot for occasion.

    ReplyDelete
    Replies
    1. I laff sotey mess fall from my yansh 🤣🤣🤣🤣

      Delete
  41. TASTE BLISS CAKES AND PASTRIES7 August 2023 at 14:29

    Hustle oooo make they no tell you for occasion say rice still dey but meat don finish.

    ReplyDelete
  42. TASTE BLISS CAKES AND PASTRIES7 August 2023 at 14:30

    Hustle ooo make you no share one room with seven children.

    ReplyDelete
  43. Hustle o so that your neighbor will not hear your knock and off their generator or inverter thinking you have come to charge phone

    ReplyDelete
  44. TASTE BLISS CAKES AND PASTRIES7 August 2023 at 14:31

    Hustle oooo make you no see enjoyment as waste of money.

    ReplyDelete
  45. TASTE BLISS CAKES AND PASTRIES7 August 2023 at 14:34

    Hustle oooo make 70# bank charges no spoil the money you wan withdraw.

    ReplyDelete
  46. TASTE BLISS CAKES AND PASTRIES7 August 2023 at 14:35

    Hustle oooo make them no blur your face for group picture.

    ReplyDelete
  47. TASTE BLISS CAKES AND PASTRIES7 August 2023 at 14:36

    Hustle oooo make ShopRite no be like USA for your pikin eye.

    ReplyDelete
  48. TASTE BLISS CAKES AND PASTRIES7 August 2023 at 14:37

    Hustle oooo make them no use tinted glass carry your babe pass you for road.

    ReplyDelete
  49. TASTE BLISS CAKES AND PASTRIES7 August 2023 at 14:38

    Hustle oooo make your soap no flat like sim card.

    ReplyDelete
  50. Hustle ooo make them nor invite you come your own papa burial unto say na them take care of the bills.

    ReplyDelete
  51. Hustle o, make you no dey borrow to pay for passport.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Wickedness abounds on this blog😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂

      Delete
  52. Hustle oooo, make your Calls and messages no dey enter voice mail 🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  53. Hustle soooooo, make you no go snatch community prick wey get incurable std, no house and borrowed car.😲

    Hustle o, make dem no use audio car and audio visa take you do yeye.🙆‍♀️

    Hustle o, make you no dey visit unnecessary visit because of free food.😒

    Hustle oooo! Make dem no use only the last minute of family meeting ask you 'ehen, any thoughts??'

    Hustle, I say hustle o, make people stop to dey avoid your calls. As per everybody know say na only begging and bad news you sabi.

    Hustle o, make dem no dey count things when you enter anywhere and when you commit.

    Hustle o, make dem no by mistake give you money as per conductor.

    Hustle oooo, make you no follow pesin wey dey use bread nylon as condom. ( I can never forget that comment abi chronicle)🤦‍♀️

    Hustle o, make your siblings no use your aso abi as table cloth.🤣 (True story)

    ReplyDelete
    Replies
    1. The last 2 na die😂😂😂😂

      Delete
    2. 🤣🤣🤣🤣
      The bread nylon post was a comment on one in house gist like that.

      Delete
    3. 'ehen, any thoughts?’
      Anwuo m o 🤣

      Delete
  54. Hustle o, make you no dey form alpha malu for blog, 2k for street.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Who get this shade biko?
      He shul carry basin cum pack am o😃😃

      Delete
  55. Hustle o, make dem no use 1 cloth identify you. Na Tunji...ehen...Tunji na...green polo..

    ReplyDelete
  56. Hustle o, make you no dey break people bed for a living... You go old one day.

    ReplyDelete
  57. Hustle o make dem begin invite your pikins for birthday party because now your pikins go spoil birthday pishure with their anyhow cloth/shoe and hair. Dem no get gift to dash the celebrant sef, so no invite for Dem.

    ReplyDelete
  58. Hustle o because I get am before no be property

    ReplyDelete
  59. Hustle make your former days no better pass your latter days

    ReplyDelete
  60. Hustle o make you no dey call your ex dey beg for money

    ReplyDelete
  61. Hustle Hard oOoOO cos there's a huge difference between "Have a seat* and *find somewhere to sit*

    ReplyDelete
  62. Hustle o, make gateman no see you begin frown face as you no dey drop something

    ReplyDelete
  63. Hustle oooo, make e no be say na only inside dream you dey see betta food.😒

    ReplyDelete
  64. Hustle o, make landlord no remind you about rent 6 months before e expire

    ReplyDelete
    Replies
    1. 🤣🤣🤣🤣😂😂
      I can relate to this
      Our caretaker always calls us three months to expiry of rent to remind us

      Delete
  65. Hustle make your children no ask you for old age say wetin you use your younger years do.(true life story o)

    ReplyDelete
  66. my brethren hustle o make you no dey off your mobile data😂😂😂

    ReplyDelete
  67. Hustle o make your sister or brother pikin no ask you say "sebi you sef born pikin, why you no ask am for money?"

    ReplyDelete
  68. Hustle o make you no dey use opera mini browse without pictures😂😂

    ReplyDelete
  69. Hustle o make you no dey fight for occasion because of food

    ReplyDelete
  70. Hustle o so that you go begin like and comment on vacation pictures of your friends.

    ReplyDelete
  71. Hustle o, hustle o, hustle o, awon 'I lyKke my woMan naIshuRral,' because d truth be say you know say one shingbai no dey your hand to buy wig or make up for pesin.

    ReplyDelete
  72. Hustle make you no dey carry nylon for your bag wey you go use pack food and drinks when you go occasion😂😂

    ReplyDelete
  73. Hustle o so that when something lost for compound, dem no go suspect you

    ReplyDelete
  74. Hustle o, so in case jollof rice no reach you for occasion, you no go dey vex, dey hate on people wey share food

    ReplyDelete
  75. Hustle hard make pastor no dey use your name do bad example when preaching

    ReplyDelete
  76. Hustle o, so your spouse no go say you come from a family of paupers

    ReplyDelete
  77. Guys I am on roll🤣🤣🤣🤣
    Today sweet die, off to boxing ring😂

    ReplyDelete
  78. Hustle hard make bank security no dey waste your time for entrance door.

    ReplyDelete
  79. Hustle o my bvs so you can drop comments with your full chest, instead of going anonymous to spew vile so your goody two shoes blog id can be considered for give away🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  80. Umunnem hustle o so you won't be cooking up sob stories to fleece people of their money

    ReplyDelete
  81. I say hustle so you will not claim to be a widow/widower cuz of giveaway

    ReplyDelete
  82. Hustle o, you hear, make Shoprite by the bread counter no turn to studio for you.

    ReplyDelete
  83. Hustle o, I say hustle o, no be to born pikin dey look for how to feed am yam and beans at 3 months.😏

    ReplyDelete
  84. Hustle o, hustle hard o. Make 5 years no pass, you dey warm past grievances like soup.

    ReplyDelete
  85. Hustle o, I say hustle o, so that you go dey call person wey you fit born 'momma', afi momma gbokpa 🤣🤣🤣🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  86. Hustle oo, so your car fuel gauge would not always be red and you use your remaining energy to rack your brain and end up suspecting fuel attendants

    ReplyDelete
  87. Hustle o oooh hustle noooo, hustle oooooo so you no go dey use piece of meat train your pikin.

    ReplyDelete
  88. Hustle ooooooo, no go marry wetin you no understand because of generational hunger.

    ReplyDelete
  89. Hustle Ooooh!!! So when your pikin vex, e go fit go upstairs. Make he no vex go passage where tenants go dey ask shey mummy/daddy e lu e ni 😂😂😂

    ReplyDelete
  90. Hustle o, make dem no use one lean shawarma and half cup ice cream toast you.

    ReplyDelete
  91. Hustle o, better hustle, so that you will stop condemning every little thing as 'worldly things' mean while na poverty and 3D hunger dey worry you.

    ReplyDelete
  92. Hustle o,you hear? So that people no go dey always call you eat remnant wey dem no wan throwaway. As per 2 legged bingo wey you be.😒

    ReplyDelete
  93. Hustle, make eye service no woundjure you for eye.

    ReplyDelete
  94. hustle o make babe no save your number as tear tear boxers lolol

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141