Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Putin And Him Boy Boy Wagner Been Dey Act Drama Since

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Sunday, June 25, 2023

Pidgin Post - Putin And Him Boy Boy Wagner Been Dey Act Drama Since

You dey follow International news since? Drama just full ground anyhow with that man wey dem call putin wey dey fight with Ukriane since......The thing wey happen be like when person train monster wey come wan chop am...

One man wey dey in charge of Wagner group wey President Putin dey support run things with come say e wan comot Putin and become President and for some days him and him army begin match go Moscow to go collect power for Putin hand....
Wagner chief Yevgeny Prigozhin and him boys don turn back sha but baba Putin say na big crime dem commit and must pay the price......
I been don happy well well for wetin Wagner been wan do and even say him don turn back, me think say wetin him do disgrace Putin well well oh... Abi how you see am?

12 comments:

  1. Lol
    Putin was all shaky and scared yesterday but for the swift intervention of Belarus' Lukashenko

    ReplyDelete
  2. Wish citizens joined the uprising. E for good.

    ReplyDelete
  3. There would have been bloodshed and casualties. I knew they won't carry out the threat just like I told someone earlier.

    You don't inform someone or an enemy you're coming to capture him.

    ReplyDelete
  4. Even the mighty are afraid

    ReplyDelete
  5. Na epic disgrace and e for good oooo.
    Putin no even believe say that kind thing fit hapun to am.

    ReplyDelete
  6. ๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚nor be small thing oh...I for like say e happen at least e go distract Putin small from Ukraine matter

    ReplyDelete
  7. Believe that Wagner Chief drama at your own expense. You dey whyne ex-KGB boss like Putin? Make the West and Ukraine dey play๐Ÿคฃ. Putin go commot or die one day but no be Prigozhin go kill am. As a matter of fact, Yevgeny is a dead man walking if indeed he is not acting on Putin's orders.

    Na Netflix movie dem just act so and it is quite funny and shocking that the west is buying it. As the world come focus on the "Russian crisis", Putin don use the 24 hours run the coded level wey he wan run underground. Every member of Progozhin's family including the ones wey still dey inside belle, Putin know where dem dey and can wipe off that lineage with just one order. Putin knows it. Prigozhin knows it. Russians know it and the west ought to know this too.

    This is a classic scenario of "Russian disinformation" which is one of the most effective weapons in their secret service. Let me recommend "The Spike" by Robert Moss to any willing reader. Putin needed to distract the world for 24-48 hours for reasons known to him and he don achieve the aim. As soon as he achieved his aim, he probably ordered Prigozhin to call off the drama and the Kremlin interestingly says he would not be punished. I pray for a quick end to the war and all wars but this one wey happen so, dem plan am mbok. It's too good and easy to be true๐Ÿ™„.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Well written!! my exact thoughts. except say life don really tire Prigozhin and he's looking for assisted suicide for him and his entire family

      Delete
    2. You don talk every every wey dey underground but you come miss the one tinkele word wey NATO dem take dey describe wayo from Russia, dem say na MASKIROVKA Putin do,na wetin wey our people dey call "the more you look the less you see". Kawai.

      Putin no fit kill Prigo na im paddy, onto say dat Wagner group sef na tachere group of 25,000 army wey wan go face 1,2000,000 Putin army, e no possible,ko rara.

      Any which way, Putin don know say no be only Ukraine dey fight am, wetin e wan see e don see these past few days.
      E go change tactics now but im go first act action film, arrest Prigo from Belarus.
      Make we dey look.

      Delete
    3. My only problem with this narrative be say, Putin vex in front of Russian public, on to say him boy dey do anyhow. Him people usually go dey exempt from the ruse, if na wetin e be b dat. Another version na say the oda side don make Prigozhin money offer wey he no fit refuse, but he come see say he no go fit carry through . E fit even be say Putin dem sabi if any offer dey ground and dem tell am to collect am, com act film for the payors, make their money no too waste.
      As e dey so na only Prighozin sabi the full tory, God epp him.

      Delete
  8. Putin put up that film to distract the world….guy is badass abeg,he is steps ahead.whoever paid that block just waste him time.filmtrick na Im Putin n bad guy do dem

    ReplyDelete
  9. My friend called me yesterday to give me this gist, for my mind how this one take helep me, na puttin sabi wetin dey worry am jare

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141