I hope say you sabi who mummy of Naija be?
Some people dey say mummy of Naija Aisha no suppose arrest the pikin wey write say she don fat because she dey chop poor people money but others say e good as she arrest am because the pikin follow for those wey support the killing of Deborah Samuel wey dem burn alive say she write something for WhatsApp group...
The pikin post for Twitter say anybody wey dey support Deborah make no near e side or e go deal with am... How you see am? Na Karma or nah Nemesis? I n support say make mummy of Naija oppress anybody oh but for this one i give am thumbs up!
Good for him.
ReplyDeleteI saw the midget, by the way his eyes was popping out of it socket, Those DSS must have dealt with him. Hope he has learnt his lesson
ReplyDelete🤣🤣🤣🤣🤣🤣 lemme head to Google to see for myself 🏃🏽♀️🏃🏽♀️🏃🏽♀️🏃🏽♀️
DeleteSame here Stella, I be dey vex when I read say mummy of Naija arrest am, but, when the tweet come surface na him I fas fas remove my support from de pikin bodi.
ReplyDeleteMummy of Naija, well done ma ooooooh, you do well ooooooh.
Same i been vex too,but now don leave them arewa alone to settle themselves.
DeleteSince he was among those who gave Deborah's family sleepless night plus pains that will never go away..let him enjoy the punishment plus more suffering is coming his way.
ReplyDeletePikin way say him mama no go sleep him too no go sleep.
They released him when they realized he supported the killing of Deborah
ReplyDeleteHmmmmmm!
DeleteNothing surprises me in this country, ABSOLUTELY NOTHING!
Me I vex wen i hear the news say mama arrest the small boy.but when I con find out say he surport the people wen kil Debo I con change my mind con surport mama..at least he don learn him lesson well well ..
ReplyDeleteNaija mum ndalu.
ReplyDeleteThey don quick release the boy because him be their tiwan tiwan. If na person from other part of the country he/she might still dey there oo, hmmm. Naija! Kuma, I don talk am before shey na family matter them go settle am
ReplyDeleteHis Karma no waste time.
ReplyDeleteOn another note. The boy don turn celebrity
No sympathy
ReplyDeleteNa God take style reset his life with small bearings from DSS
ReplyDeleteThe boy is a fool for his insensitive comments about Deborah, that being said mummy of za oda room should go pick on someone her size
ReplyDelete