You see the Video of the woman wey blind because she go follow person wey color eyes? You no see am? Ok make i yarn you!...
The story be say, she dey follow one motivational speaker wey she dey look up to for instagram, so as the babe come change color of her eyes with color, she sef come follow go do am and now she don blind, the two eyes don swell up gum together and doctors say nothing wey dem fit do because the eyes grow another layer out of infection...
Meanwhile person wey she go copy, nothing do the person oh....
Her small daughter warn am before she do but she no hear... The tortoise go drag shoulder say e no go stop until dem disgrace am.
Now the Lawyer and mama of five pikins don no dey see road again!
You see wetin follow follow cause? Make you find your road make you no lorse oh!
Motivational wetin? Abeg motivate yourself to better things!
I be read the story yesterday. Na so I jus hiss waka comot.
ReplyDeleteThe thing wey copy copy go coss for dis we life ehn, mouth no go fit to talk am finish.
I no dey piti pipu wey dey allow demsef dey carried away wit wetin dem dey see for soso midia. Na her children I piti. Who is this motivational speaker sef?
ReplyDeleteAnne K
Yes ooo,follow follow enter gutter.
ReplyDeleteJust negodu.
ReplyDeleteWhat Instagram will cause eh?
ReplyDeleteNdo to her.
Apologies sha but they should find her a smooth ass walking stick.
Hahahaha @smooth ass walking stick
DeleteA whole educated person with pikins dey follow motigbetional speaker. Na real wa for her