Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Parental Kunfu

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, November 04, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Parental Kunfu

Ah ah....







Kpoi! Kpoi! Kpoi! Area! Na who dey?!
I greet o!
Stellamambamamalade...how de terrain?! I hail o!


Mah gist you this one wah hear!

My childhood friend reconnect recently, last time we see, i know say na her papa she dey follow live for PH. Her mama and twin brother dey live for Lagos.


She say her parents don reconcile and begin live under thesame roof. Udonminit!


I say how manage?
Choi, for this life i never see woman wey tough pass that her mama! Pikin go fall and wunjor! Before she treat the pikin, she go first give am ambulance inducing beating,with anything wey dey radius o!


I never see her smile or happy for once! If we go near their compound sef, she fit say why you no carry first for class?!


Abeg as her twins dey carry first and second, and i know say na we we go chop the kpako biscuit gift together, why i go wan come become bad belle and put asunder their wetin wetin! Mba o! *clickstongue!*


And some plenty pipu sef dey wee class, wey dem parents go exile dem, if dey nor carry between First an Tenth!


As i dey practice love thy neighbour as thine self. I just say mah shill! Na twelve we be for class we never reash twenty!


Enor matter as na me be the twelfth disciple wey Jesus love pass! Na twelve i carry, anor sell Jesus! *popsgum!*sideeyes!*


Her papa own na stubborness! Tell am say day don break, he go argue you say na Nepa on light for sky! Very difficult a couple!


After they seperate and go marry another person for almost 10years?! Wetin happen?

She say all the parent's seperate efforts to born more children with their new spouses nor work! Eleeeeeeh!

I say ha! That one serious o!

She say na so her parents, from seperate spiritual sources and personal dreams, see say their only children, the twins kpai!


Na wetin come make the parents reconsider to come back together and raise the twins together.

I say so as una don reach marriageable age to comot house, wetin come remain?!


She say the condition na make the parents dey live together under same roof to raise dem, she say e no consine anybody if dem dialogue or do waka pass!

I say that kain condition hard o! I say wetin cause the seperation in the first place?

She say simple thing o, their mama nor like to dey chop okro or any draw soup, say na backwardness the thing dey cause But their papa like swallow and fried snail pass anything, and he nor dey gree chop without okro!


Na as dem begin experience problems for their joint business, her mama wey be Margaret Thatcher twin sister, carry blame put for the papa head. Say the man dey possessed and na enemy of progress!Hian!


Her mama na church she dey attend, her Papa say he wan embrace him ancestor legacy, begin consult oracle for sitting room inside broad daylight.


Na duplex be their harse, the Papa hol dan, the Mama na up. Nothing dey join dem together except main door.


*I for suggest meh dem kukuma put ladder for window for their mama, as dem two wan dey behave like Taataa! *Tufia!*


She say na part of wetin dem tell her mama for church be say,, the man dey put hand for juju things! Say make the wife no prosper reach him!


And he know say okro na the woman taboo, but he go still wan dey form man of the house!
*this one na we rise by unlifting others!*


I say ehn, plate finish for una house? wey your mama nor fit dish soup without okro?! Abi she nor fit lem her portion inside kitchen?!


She say her papa say he no trust their mama, say dey must to eat together from same plate! Kiikiiiikii... God beg o!


This man nor be only paranoid, he still nor gather wisdom say antidote dey, wey person fit drink to prepare the belle for any mishap!


I say abeg, how dem even meet to marry in the first place as their house dey always get one kain strange energy.


My friend say na their two grandmothers do them arranged gini gwanu say, my friend pikin must marry my pikin! * na real wa!*


I say how she dey cope? She say wetin consine her! She say sunday she follow her mama go church o...I say your twin brother nko?


She say Bobo wey dem because reunite, don go rent house for Island. I say why she remain there?! She say remain where?


My friend begin laugh say, she wey deliberately go find job for Abuja wey go carry her comot their middle.


Anytime she go house, she say even as dem get different beliefs, not for once did she settle quarrel for the two of them.


Na older family members dey help dem settle matter! She Say na their housemaid dey cook for the parents after plenty back and forth.


The one wey like okro dey chop okro, the one wey like Egusi dey chop Egusi!
*so dey fit agree to meet for middle, and it took dem 10years to realise it!* No be juju be that?!


I say so when you wan marry now, na which religion go host the wedding?


She say her papa and im ellow occult go do traditional, her mama and church members go do Church wedding!


I say no be confusion you wan carry give your inlaws like so?!


She say which inlaws, she say her husband na Atheist plus orphan . I say which one be that?!


She say those ones wey believe say, their ancestors na from frog dem follow come! Ohh! I say that one sef dey very ok!


She say i think so? I say no be say i think, i know so! Everything dey very ok infact! *sideeyes*


*From confusion to disaster! Your parents never balance, you wan put neck enter the one wey go map your face like him ancestors!*


Abeg na who you wan report am give? Wetin i dey even talk sef, your papa na oracle, your mama na deaconess! Tanker don full! You wan carry umbrella? To do wetin na? Bomb dey look face?!

Mah dey leg go house o jere!

9 comments:

  1. 🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣
    I swear e don reach like one week, I laff like this.

    ReplyDelete
  2. 😁😅🤣😅😅😅😅

    ReplyDelete
  3. 🤣🤣🤣🤣... sis na werey you be.

    ReplyDelete
  4. 🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣
    Tins dy happen oo

    ReplyDelete
  5. Na today i confirm say, dem no give u ur injection complete

    ReplyDelete
  6. wahala be like bicycle

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141