Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - New Tenants Alert

Pages

Advertisement

Friday, November 18, 2022

Sisi Senaponi's Corner - New Tenants Alert

Laugh Out loud...







Una doh o! Yard pipu dem dem! I greet o!


Stellaportland-deamericana! I salute o!

Wonder nor dey ever end e!
Landlord bring new tenants come yard, Two bros wey get muscle like bouncer!

For inside broad daylight, na im dem go tie 2year old pikin towel for west!


*Inside this hot afternoon, wey blood pressure and other things fit rise!*

Ehn?! Na which kain thing be this biko?!

Small time, Reverend Sister begin wear nose mask for eyes! As na near her window dem carry gym gym bench and rod keep!


Na so dem go spread leg for bench dey carry iron like Tom cruise!
*persin eye nor go fit comot the kpalakpolo near dey toweh!*

Ehnn?! Landlady sef don begin wear bumshort under sun and moonlight! While Mama Ejima nor dey gree wear Bra under wrapper again!


Small breeze, na im she go fall yakata for tenant lap! *sideeyes!*

Landlord nor fit talk, as he don carry him senior put for haase!

Make persin nor carry blokos block me for backyard o! I bind and cast!

Na inside fast i dey so! E get plenty things wah dey worry God for abeg! *popsgum!*

*nor be today gum i pop, na yesterday own i pop for today!*


I sha no wan hear say, person thief Mama Ejima virginity, for where she keep am! Nothing wey persin nor dey kukuma see inside this Lagos! *clickstongue!*

16 comments:

  1. Siiiiisiiii!!! Oya na, con enta heaven, make ah see!
    😂🤣🤣🤣🤣
    E say dem fit use blokos block am for backyard. Wetin wan carry you go backyard when na upstairs you rent hass put? Tok tru😏.

    ReplyDelete
  2. 😂😂😂😂😂una don enta one chance for una compand be that oo.

    ReplyDelete
  3. Sisi...you no need man? God don bring two better men come ya yard and you dey do payer and fasting weh i no understand. You go dey there dey slack allow landword wife and mama ejima "snatch" this fine young men wey get akpobi from you. You dey dull oh.

    ReplyDelete
  4. Lol take blokos block you for backyard

    ReplyDelete
  5. This sisi sef , which one be make Dem no thief mama Ejima virginity

    ReplyDelete
  6. God don answer you, just pick one from the two of them


    Oracle of God

    ReplyDelete
  7. The Laugh from this post every Friday is good to ease Nigeria stress

    ReplyDelete
  8. 🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  9. I get one Neighbour like that before, na only im be man for all the 12 self contained bungalow apartments and na so e go Dey waka around in cotton dross. Omo bros carry timber under. Anyway before e relocate outside the country, e clean almost all the pipes for compound sha. Na like 5 times me I do too

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141