Laugh Out loud...
Stellaportland-deamericana! I salute o!
Wonder nor dey ever end e!
Landlord bring new tenants come yard, Two bros wey get muscle like bouncer!
For inside broad daylight, na im dem go tie 2year old pikin towel for west!
*Inside this hot afternoon, wey blood pressure and other things fit rise!*
Ehn?! Na which kain thing be this biko?!
Small time, Reverend Sister begin wear nose mask for eyes! As na near her window dem carry gym gym bench and rod keep!
Na so dem go spread leg for bench dey carry iron like Tom cruise!
*persin eye nor go fit comot the kpalakpolo near dey toweh!*
Ehnn?! Landlady sef don begin wear bumshort under sun and moonlight! While Mama Ejima nor dey gree wear Bra under wrapper again!
Small breeze, na im she go fall yakata for tenant lap! *sideeyes!*
Landlord nor fit talk, as he don carry him senior put for haase!
Make persin nor carry blokos block me for backyard o! I bind and cast!
Na inside fast i dey so! E get plenty things wah dey worry God for abeg! *popsgum!*
*nor be today gum i pop, na yesterday own i pop for today!*
I sha no wan hear say, person thief Mama Ejima virginity, for where she keep am! Nothing wey persin nor dey kukuma see inside this Lagos! *clickstongue!*
Na wa 🤣🤣🤣🤣
ReplyDeleteLol 🤣😂
ReplyDeleteSiiiiisiiii!!! Oya na, con enta heaven, make ah see!
ReplyDelete😂🤣🤣🤣🤣
E say dem fit use blokos block am for backyard. Wetin wan carry you go backyard when na upstairs you rent hass put? Tok tru😏.
😂😂😂😂😂una don enta one chance for una compand be that oo.
ReplyDeleteSisi...you no need man? God don bring two better men come ya yard and you dey do payer and fasting weh i no understand. You go dey there dey slack allow landword wife and mama ejima "snatch" this fine young men wey get akpobi from you. You dey dull oh.
ReplyDeleteO lagbara o! 😂🤣😂
DeleteLol take blokos block you for backyard
ReplyDelete🤣🤣
ReplyDeleteThis sisi sef , which one be make Dem no thief mama Ejima virginity
ReplyDeleteGod don answer you, just pick one from the two of them
ReplyDeleteOracle of God
The Laugh from this post every Friday is good to ease Nigeria stress
ReplyDelete😆😆😆
ReplyDeleteUna don jam.hahahah
ReplyDelete😅😅😅😅
ReplyDelete🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣
ReplyDeleteI get one Neighbour like that before, na only im be man for all the 12 self contained bungalow apartments and na so e go Dey waka around in cotton dross. Omo bros carry timber under. Anyway before e relocate outside the country, e clean almost all the pipes for compound sha. Na like 5 times me I do too
ReplyDelete