Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Madam Benz And The Maid

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, November 14, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Madam Benz And The Maid

Na wah!






Una doh o! SDK pipu of life! I greet o!

Stellapianothumbulina! How de mediteria?! Una see sun? Oraizon gallant?! I hail!

Kiikiikii...God abeg o!

My customer tell me say she dey find housemaid!

I say wetin do the one wey dem bring her for January?!

She say she nor understand the girl behaviour!

I say she thief? She say No! I say she follow man? She say Mba!

So wetin she do?

She say as na Two bedroom flat dem dey live, and she get two Boys wey just finish Secondary school!

She say she put small mattress inside the Boys room for the Maid.

But one day wey she enter fheir room, she see as the maid dey dress inside the room, and the boys just dey do like say e nor mean anything! *clearsthroat!*

I say so how she reason the matter?!

She say Abeg o, she nor want make one foolish geh come corrupt her boys! *sideeyes!*

Na so she port the Maid go parlour! She say make she dey sleep near Dinning area with her student mattress!

Small time, Customer say she notice say her Boys nor dey gree go sleep in time! Say dem go follow Maid dey parlour, dey watch film till 11pm sometimes!
Wey dem go dey explain the Oyinbo film give her!

Madam say she don ban dem from that film watching, because small thing nau, man and woman don begin romance!

She say so her Boys nor dey stay Parlour after 9pm again!

I say problem solved! Wetin come happen again?!

Madam say she begin notice say, her husband go disappear for middle of night from bed! She wey don taya, she nor dey quick put mind!

Na for morning Horseband go tell her say he dey work for laptop and he nor wan disturb her! *popsgum!*

My Customer say one night, na im she wake up say make she check say everywhere dey locked, as she too tire to check before she sleep!

I say wetin do your Husband wey he nor dey check una sekuriti?! She say na busy man and he travel that period!


*clearsthroat* Man wah sabi say na woman house he go lodge for one week!

*One Aunty wey get behind like V-boot! Na she he first propose to, but as he see say this my customer get small change for hand, He leave Vboot, come marry Benz! When Vboot dey hungry am, na work e dey use cover to wakawaka!


Vboot neighbour tell me say, if i hear how he dey use instrument damage Vboot! Say na so she go dey shout! Dey cry like small pikin! Kiikiikii!


Na Benz money, he dey use nourish Vboot! As Benz na prim and proper and Vboot na Askamaya! Sense nor go kee that man!


Madam Benz go parlour see as maid sleep for floor with leg open yakata! Wetin be this?!
She say she wake this geh, she nor gree wake!

* e get some people wey sure me say dem go miss Rapture! Nor be say because dem commit o! Mba,Na because this kain sleep wey dem dey carry spiritual ear muff go sleep! Person carry pangolo knack, na waste of time!*


Na until Madam pour maid water for face! Before she wake!

I begin look this woman!

I say how the Maid take disturb for Parlour wey she sleep?!

She say No o! So na like that she don dey sleep all these while! Dey open leg yakata! So if her husband come like that! Na wetin he dey see!

I say madam better calm your gini gwanu! Man wey go do, go do!


Nor go carry hypertension put for chest!

This one wey you don pursue her comot na, your husband still dey find network go parlour?!

She say Mba, he say wifi don dey connect inside room! *sideeyes*


E must to connect! Yeye!

As you don pursue cardi B go na! God go hep you, na Nikki wey disguise dem go carry gee you!

17 comments:

  1. See me laughing my heart out


    Tblack

    ReplyDelete
  2. Maid wey her sons and husband don knack Tey Tey....hahhahahahaaaaaaaa
    Wahala, person wey dey stay 2bedroom flat with children be like sefcontain, privacy no dey fit dey mostly of them no dey willing to observe privacy.

    ReplyDelete
  3. Wifi don dey connect inside room, kikikikikiki I laff in Morocco

    ReplyDelete
  4. 🀣🀣🀣 Sisi don carry enter yard o.
    Sisi abeg where you dey get all these names you dey call stella 🀣🀣 osino Stellamapiano🀣🀣

    ReplyDelete
  5. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

    ReplyDelete
  6. 🀣🀣🀣🀣🀣🀣🀣

    ReplyDelete
  7. Person dey hire maid but you don't have a room for the maid to stay except in your grown up boys room and beside dining.
    May God help us to be able to train our children and give us a government that care about the welfare of citizens.
    Even if you are an orphan at least you go dey get small change from govt to hold body if you don't have a job.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Abi, why get a maid when you don't have a suitable accommodation for her. Some women are just unorganised.

      Delete
    2. Siblings, cousins of different genders sleeping together is now a problem sef not to talk of a female maid and male teenagers. Not forgetting the husband wey dey work for sitting room also.

      Delete
  8. Why pour water on her employee? This woman sounds like an awful person. 2 bed apartment with a maid. Silly.

    ReplyDelete
  9. Wahala be like wetin again

    ReplyDelete
    Replies
    1. Bicycle!! Lol thank me later!
      Ms K

      Delete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141