Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, November 11, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Advice Gone Wrong

Kpoi! Kpoi! Na who spread fish for aside? Inside this economy wey breeze dey grow hand, wear trawziz and dunlop?! I greet e!






Stellapepperoni-magarita! How de oraizon?! I hail o!

Nna ehn, this life no balance at all.


E get one Aunty wey dey live the second street, she been follow Mama Nedu gist well well. Fine lady, but no husband yet.


I don hear gossip say maybe na because she nor dey too mingle or socialise with people arand!*sideeyes*
*If she mingu na, na dem go carry olosho give am as alias!*

Anyways, na so i notice say i no dey too see her come follow Mama Nedu buy market. I say make i ask after her!

Na im Mama Nedu tell me say, e get one neighbour for that Aunty Clara house.

She say the woman na Alhaja, wey dey like to follow her relate and counsel plus, she get grown up children for house.

So na im this Alhaja advice Aunty Clara say, time don dey go. Make she find man knack am belle! Say make she kukuma nor bother tell the man. So she go jor dey the compound dey nurse the pikin by herself as husband nor gree show!


Hmm...i ask Mama Nedu how she reason the matter?!

Mama Nedu say this Alhaja daughter na first and only wife for her husband house, wey don born 4 children with one, one year in between.

*Person wey dey advice make another person pikin turn single mother! Hian!*

Na im Aunty clara say she notice say Alhaja first son begin look her one kain seducing manner.

The uncle go dey follow breeze near Aunty clara door for evening time! *sideeyes*

Small time na im Aunty clara carry belle o! She nor tell Uncle anything o.

Small time she travel go born for the Abroad, since na obodo citizen she kukuma be!

Na so uncle fall sick o, wey dem carry him from one hospital go another!

Na im Alhaji waka waka wey dem tell him say him blood dey aside! Say e get some kain family prayers wey dem suppose do the pikin!

Alhaja press the children belle for truth, nobody confess o!

Na im Alhaja waka her own, wey dey tell her who and where the pikin dey!

Uncle don try call Aunty Clara, ask if she get belle. Aunty say which belle?!

Uncle put Alhaja for phone, na so she begin swear for Aunty say she better bring the pikin come him papa house!

Aunty Clara say, she nor know wetin dem dey talk about o!

She say aftoroh, nor be Alhaja advice her make she do wetin she come dey curse her on top! *clickstongue!*

She say she nor follow dem see any pikin wey loss o! Shullincase their pikin blokos loss for road! *kiikiikii*


God abeg e! 


This one na like thief wey teach person how to thief, the new thief come sabi work pass him mentor! Carry shakabula go rob him mentor for broad daylight!

10 comments:

  1. Hahahaha alhaja is motigbetional adviser. Na dem sabi

    ReplyDelete
  2. Lol πŸ‘ πŸ˜† 🀣
    See gbege o.
    Dem don take Alhaja learn work

    ReplyDelete
  3. πŸ˜‚πŸ€£πŸ˜‚inside life.

    ReplyDelete
  4. Lol...why she dey carry the pikins run na? Alhaja will make a good grandma sef oh.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Abi na.
      As she's demanding the baby gets home to his root.

      Wait o Sisi,how come this Aunt get money to go born for abroad and she's a citizen, wetin she dey do for local area as tenant πŸ€”πŸ₯Ί?

      Delete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141