Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponis Corner .- Office Madam Jam the Owner!

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, October 14, 2022

Sisi Senaponis Corner .- Office Madam Jam the Owner!

 Please join me in laughing, this sisi na crazeeeeeee








Una wehdone e! I greet o!


Stellaafricana-tropicana... how de body for dia?

Wonder no dey finish inside life e!


I remember the time wah dey work for Island.
Our Oga get one very fine woman wey dey come help am to supervise, anytime he travel to the abroad!


This woman tall, skin like chocolate, carry humbility join! She dey give person transport fare without even asking!


But amongst all of us wey dey there, Oga get one babe wey dey help am chop him money!
*choi, better money too good abeg!*


Even though she be staff, we sef sabi say na 'our office madam' she be! *side eyes*


So one day as I resume for work, na im I see House Madam wey use hand dey drag Office Madam for braids, from up to down for stairs!


Wetin hapun?! Wetin hapun?! Chineke!


Madam abeg nor fling person from balcony o! God abeg o, as i dey shout Madam! Madam,! adon confuse which of the two i dey refer sef! *sideeyes*


Time never even reach to open office. People wey do night sef never even comot!


Na because my roommate get colleague wey get car, na so i say make i follow dem reach Island. Instead make i begin waste transport or delay for traffic, if day too break!


Na our generator guy come tell me say, Oga go pay dowry on top Office Madam head over the weekend, as Office Madam don get belle!
I say person nor fit dey chop that kain awoof, make belle nor enter!
*E nor dey purge! Until e purge!*


The Real Madam come hear the gist, so she come wait them for office as she been monitor their kurukere from Friday night!


*any wakawaka man, wey nor dey fear him quiet wife or woman, don already use voucher buy hospital bed, ahead, ahead!'


I say now wetin Real Madam go do?! person wey don almost 45years and this man still never pay anything for her head!


Office madam na just 24years and the love never even reach 1year wey oga begin friend her for office!


Na as Office madam manage and escape, na im I run after her! How I go allow make better gist escape me like that! Mba! That isn't professional!


Office madam say she dey hotel with Oga all weekend.
Na that Monday morning wey she quick come office, to pick oga cheque book for him. Oga wan pass hotel go Airport, so he send her come!


*na make God dey protect persin from monitoring eyes wey person nor know!


Na so she say Real madam enter the office follow her, tell her say she go finish her, if she no disappear and tell her people to return the bride price!


I say that one still dey possible, i say wetin go come do this 'our belle'?! she say which belle? Kiikiikii...God abeg e!


Una wey don dey with people wey get belle know say, if person wan throw something at pregnant woman suddenly, na her dominant hand she go first use, and block the belle before her own face! Abi no be so?! *clickstongue*


Na the natural,subconscious instinct of a mother towards her unborn child!
*choi!see as english sweet!Goo-goo is working!*


As i talk wetin i talk, yes with my full chest say 'our belle', na because i know say the people wey gather get the belle pass one. Pass two sef.
She begin try use hand block the belle!


I say Bia, be like say you never see person wey go tell you the one wey be truth?!


That woman wey the Man put for house for almost 10years and she never born for am, he nor gree pay her bride price!


You wey see say the place get Gold, you nor carry spoon or shovel, na trailer you carry go!


I say you don tell Oga say you get belle? She say na why he go pay her bride price!


I say if you know say you get chest for problem, nobody go stop you o!


Aftoroh, if woman die 'ontop' man, na another woman go still sidon 'ontop' the leg of thesame man! Na the position be the difference!


I say but if she know say, she nor get any backup anywhere... Nne, that real madam wey don follow this man build all these years, You nor think say she sef wan born?!


Our Manager begin shout my name dey find me. *Na our House Madam informant be that!*


I carry 500 give her, make she quick carry bike comot, go her mama house as House madam don enter the car wey office madam bring come the office, to go block Oga alone for Hotel.


Office Madam say her phone don smash for upstairs and she wan go carry the carkey!


She say na the car she wan use and carry oga go airport!


I say make i call oga number, e dey switched off!


She say he get private number but she nor sabi am offhand.


I say maybe make i quick go help her ask House madam for oga 'private number', wey e dey use and commit Adultery!

*The number wey nor dey off when oga don comot for house but Madam nor know!*

I say be like say na bodybag she want make dem go use carry her comot, inside the car wey she bring!

My friend carry okada and comot for here first!


*You wan thief meat for pot, you still dey find cutlery!





Hahahahahahahahahahahah

23 comments:

  1. Sisi no go collect another person blowoooh, be carefulooooh hmmmm

    ReplyDelete
  2. πŸ˜†πŸ˜†πŸ˜†

    ReplyDelete
    Replies
    1. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜†πŸ˜†πŸ˜†πŸ˜†πŸ€£πŸ€£πŸ€£πŸ€£πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

      Delete
  3. 🀣🀣🀣wahala

    ReplyDelete
  4. Gbeborun unlimited 🀣🀣🀣
    I feel for the house madam

    ReplyDelete
  5. This girl.πŸ˜€πŸ˜€πŸ˜€πŸ˜€ Goo-goo is working🀣🀣🀣🀣🀣🀣

    ReplyDelete
  6. Sisi d aproko madam πŸ˜€πŸ˜€πŸ˜€

    ReplyDelete
  7. ikwakwakwa! Wahala no dey finish oo

    ReplyDelete
  8. Na only God go save this Sisi ooo.

    ReplyDelete
  9. Twale πŸ™ŒπŸ™ŒπŸ™ŒπŸ™Œ
    For d highest aproko makerπŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

    ReplyDelete
  10. Sisi is soo funny abeg. Love her gists

    ReplyDelete
  11. Me I go like know the end of this particular aproko

    ReplyDelete
  12. Your amebo no get part two

    ReplyDelete
  13. Amebo na your calling abeg😁

    ReplyDelete
  14. Very unprofessional to let gist go like day🀣🀣🀣🀣

    ReplyDelete
  15. See amebo gist o, this one sweet. Only Hod sabi wetin hapun lass lass

    ReplyDelete
  16. Until the day u go ask angry person question wey she go twist your lip for you 🀣🀣

    ReplyDelete
  17. You wan thief meat for pot you steal dey find cutlery🀣

    ReplyDelete
  18. Sisi your amebo carry award...... you run go meet office madam just to gather gist.lmao

    ReplyDelete
  19. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜πŸ˜πŸ˜πŸ˜πŸ˜˜

    ReplyDelete
  20. Make dem do ivf na-if oga want pikins.

    How young ladies sleep with married men with their full chest without fearing that ogamadam might send madness to them.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141