Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Nnamdi and the Multiple customer

Pages

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, October 24, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Nnamdi and the Multiple customer

 I don laugh tire!




Una doh o! Yard pipu dem dem!


Stellacitasemovita!...How de oraizon?! I salute e!


I remember back in the days, wah been ask Soba my former roommate, why she nor reason this Nnamdi as dem go Uni together, he sabi book but to get job hard am nor be small!

I say Aftohroh, he nor too fine! So nothing like say another woman wan snatch am comot! *Abi na?!*


Soba say Mba, Nnamdi family too get spiritual problem! Say she nor wan enter covenant with poverty! I say i hear o!


Small time Nnamdi sef go pack small children put for the front yard of their house, begin teach them English and Mathematics.


E nor too teh wey he see job for one nice secondary school.


Na from there he tell us how the principal go dey wink am eye, to come help her comot wetin nor wan loss for her west, inside her office! *sideeyes*


E say one nice young female teacher, wey begin dey like him one time, Na so princi-winchy sack the lady comot!


He say one day wey she wan kiss am by force, na so he push her comot with reflex, wey her wig go one side, her hand dislocate!
Na the same reflex he kukuma use and collect sack letter!


Na Mass he from come one day, inside public bus, wey one man ask him if he fit do home teacher, he say no problem!


The man carry him the next day go the office of the Pikin manager.


Nnamdi say the salary wey dem offer him na weekly o. And the money even pass how much he ever earn combine since he begin hustle!


Na so Nnamdi resume o, choi! He say if we see as house fine eeh, just one small pikin get two nanny and two hefty body guards.


He say everything dey go well as the pikin sef sabi book. E say he begin wonder why the parents nor want make she go school outside the house!


He say na front he dey face with the job, he say no picture dey for the walls and he never see the parents of the boy/girl. *clearsthroat*


Na so the first week go,he collect better money. He go charter better okrika shirts and trawziz!
Hin shoe wey don see life too become history.


*Praize master Jeezeehz!*


He buy me borleh and fish wey carry shoulderpad! *choi! Aclear the crime scene! No single evidence remain..Aftoroh fishhead and fishbone nor dey kukuma regrow if person plant am! *popsgum!*


The Joose wey he buy for Soba, na me drink am! As the Assistant Middlewoman and Taataa wah be! I still dey grow abeg!


*Bwess meek quick taya me as pikin! Anor know who do me!*




Nnamdi say na week two as he dey teach the pikin. The nanny say time don reach make the pikin take break and collect melecine with food.


The pikin say e don hear!


Nnamdi say e nor know as the Mathematics just enter him body and he sef come forget to press bell and remind the Nanny.


He say na as he go wee wee for toilet, come back wonder begin!


He say suddenly, the Pikin begin look floor like say na another thing dey there!


He say from that one, he/she/them begin use hand rub Nnamdi shoe. Then he/she/them go sidon for chair and begin whisper something wey e nor hear well!


He say he call her name and she shout for am say no be her name be that!


She say her name na Calistus Abednego abi na Alabama Hunter!
He say he confuse and him brain nor quick pick make he press bell call Nanny!


He say na so the pikin carry pencil begin write for her cloth and he don begin fear as she sidon again, call the Nanny by her name say 'Silly Beatrice, where are my pearls!'


He say as the Nanny hear her name for high tempo,she rush enter the parlour, she wan run back in fear!


Nnamdi still nor understand wetin dey happen! He say for him eye, na so Nanny carry intercom call the two hefty men and her second wey be Nurse!


They rush enter, say make Nnamdi pack him books, come dey go house!


He say na so the pikin rush him, jump for him back, hold hand for him neck begin talk like evil spirit!.


Nnamdi nor remember Jesus o! Na him Mama he begin shout! He say he never see small pikin that age, wey get the strength of 1thousand men!


I say when Jesus face Legion, you think say na by muscle?!


He say as the hefty men dey try pull the pikin comot, na im he hear dem they tell the Nurse to move closer!


She position with needle but she nor too near the girl!


Na as the two men manage comot her from Nnamdi back, they hold her for floor, wey Nurse gently give 'him/her/them' injection!


Una see those ones wey dey form pronoun, na because dey never sabi say na Legion dey use dem play kite!


Nnamdi say he pick race, forget shoe! But as nobody go open gate for am without permission, he say na inside the sekuriti room he hide, begin peep from the window!


He say him Nokia phone ring, na the Manager call him to ask if he still wan continue the job after the unfortunate incidence?!


He say he tell her he wan go collect treatment for hospital and think the matter!


Nna ehn, i look Nnamdi, thank God for him life!


I say so na that oyinbo sickness wey the person go get like different different people wey dey follow share one body, na im he go jam unprepared?! *chineke!*


I say he lucky say the pikin nor get any Agboro personality wey dey break bottle!


He say the one wey jump for him neck nko? I say that one na Frustrated Housewife Personality!


He say the one wey dey call her Nurse like maid nko? I say that one na Toxic Madam Personality!


He say the one wey dey use hand rub him shoe nko? I say that one na Aboki Personality, he wan hep you clean the shoe! Na brush and polish nor dey!


He say the one wey wan beat the two bouncers nko? I say that one na Samson Personality, the Bouncers resemble Lion and Bear for her eye!


I say so you nor even try wait small and see if the one wey go carry money dash you go comot? That one for be Bizabiza Personality!


He use bad eye look me!


I say nor be your fault! Na me wey sidon dey hep you rub Aboniki and tie bandage for neck!


He say he wee never return to the place again! Kiikiikii...i say you nor go collect money for today wey you go? He say he nor think say dem go pay am o!


Nna ehn, that week Friday dem pay am o! plus money for Hospital treatment and unfortunate incidence money join!


Na 50naira wah use buy Abonik,i this yeye boy come return gimme! He nor even add bandage or workmanship money! *Hian*


No wonder Soba jump and pass! Nnamdi too stingy with money pass that minister wey stingy with truth! Lai lai! Anor gree do am favour again! *clickstongue*

30 comments:

  1. Sisi, which one be "borleh and fish wey carry shoulderpad" ee? Na God save Nnamdi๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚

    ReplyDelete
  2. ๐Ÿคฃ๐Ÿ˜‚๐Ÿคฃ thank God say the pikin no bite Nnamdi.

    ReplyDelete
  3. If person no wise for lagos, to be wise again go hard.๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚

    ReplyDelete
  4. Abeg the pikin get skoi skoi or what? Nnamdi gud as you run o. Hahahaha

    ReplyDelete
  5. ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ

    ReplyDelete
  6. ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ

    ReplyDelete
  7. I don laugh tire for here๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚

    ReplyDelete
  8. ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ

    ReplyDelete
  9. ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ, chai sisi,I don laff tire. Make Nnamdi go back ooo,e no easy to make money๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃbut make em make sure say em ring bell quick for nurse to come give her medicine before she tear em cloth next time๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ. Chineke leeee ๐Ÿ˜‚

    ReplyDelete
  10. LMAO.....this one totori me o,me I go fit continue this kind work but with the condition say bouncer go dey,dey my back every minute

    ReplyDelete
  11. Sisi oooo๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ

    ReplyDelete
  12. Why Nnamdi no continue na? Shebi na to dey always remember to call nurse when its time for her injection.
    Na wa for the nanny and nurse wey no fit remember on their own sef.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Exactly, him fit continue, those wey dey work for psychiatric hospital nko? But dem for tell am wetin dey so him no go fall victim.

      Delete
  13. ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ
    I don laugh tire for work

    ReplyDelete
  14. The pikin is possessed and needs serious deliverance

    ReplyDelete
  15. Abeg i need address o for this kain job.

    ReplyDelete
  16. ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ Nnamdi see wetin pass him power he pick race.

    ReplyDelete
  17. ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ Nnamdi see shege

    ReplyDelete
  18. Nnamudi come see werin passam kikikikiki, sisi why not take the job instead nah

    ReplyDelete
  19. Sisi ooo, abeg my belle dey pain me ooo. Lol

    ReplyDelete
  20. Kai...that pikin head no correct oh. Poor girl.

    ReplyDelete
  21. OMG!!!๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ,l Don laugh tire and I feel so relieved.๐Ÿคฃ๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚,but that child needs deliverance

    ReplyDelete
  22. ๐Ÿ˜ฎ๐Ÿ˜ฆ๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜๐Ÿ˜ƒ๐Ÿ˜๐Ÿ˜€

    ReplyDelete
  23. "Aclear the crime scene! No single evidence remain" lol

    ReplyDelete
  24. ๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜„๐Ÿ˜„๐Ÿ˜„๐Ÿ˜„๐Ÿ˜‚

    ReplyDelete
  25. The funny thing it might not be spiritual it might just be tapeworm or a tumor in the brain dey cause this violent behaviour and personality change. Also it could be the child had syphilitics. But again only God knows

    ReplyDelete
  26. ๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚ I don laugh tire. God have mercy upon us!!! Sisi you nah character too

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141