Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Inside Life

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, October 17, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Inside Life

 Hahahahahahahha.....




Kpoi! Kpoi! Kpoi! Na who dey haase e?!

Stellabasma-jellof...how de weather?! I hail o!


Nna ehn, this kain rain wey dey fall suddenly for this period, traffic jor plenty anyhow for Matron side! Choi!


*Even as pampers don corss,and protection still dey affordable o!* *clickstongue*

Adon kukuma dey use eye calculate the ones wah go chop their Rice before person enter village for December!


All dem Mama Christano and Papa Ronaldo! Make God have Messi on them for delivery day abeg!

The ones wey na Overcomer & Conqueror (election twin babies) when election go well, na Pounded Yam i go balance and conshume!

God forbid say person go get reason to name pikin Tuffy or Kally as short for Tufiakwa and Calamity after elections o! *God abeg!*


I jam Nnamdi as i been come from Matron side, they jor install AC for clinic reception. I say mah go collect small breeze for dia!


Abin nor know say the AC na 360 Goatpower! The thing go first vibrate for 10minutes before e begin blow thyphoid breeze!

Small time the breeze sef go switch to handfan mode, after that one, na shisha mode follow!!

Na so smoke full everywhere! The patient weh sidon under the AC, remain small wey her Badagry Shuku sef for catch fire!


The yeye electrician dey shout na sometin sometin horsepower! Na horsepower!


Asay oga abeg, shift mah pass,anor get strength for argument this evening biko!


You geh luck say nor be me you carry that kain AC come give! AC wey be say only God know wia dem go thief the thing and resell!

Fit be one deliverance place wey one evil spirit wey dem comot for customer..sorry, member body, jump and hide inside the AC.


As the half-baked pastor nor carry better anointing to see where e hide, and send am comot go where Haruna gather goats and pigs dey sell...sorry i don forget say na Lagos we dey!


Before the pigs sef go treck, reach Lagoon to jump and enter! Nna ehn, i go suprise if hungry bandits nor kidnap them finish!


No body dey tell evil spirit if na with fry he wan take re-die abi na boil he wan boil!*clickstongue*


All those ancient evil spirit wey nor dey check calendar see say we nor dey Elijah era!

I comot there, naim i see Nnamdi, he come greet him Babe. *clearsthroat*

Abin wan wait mah meet the babe.

But anor dey sure if i go fit 'not' ask her, if the bros wey come drop her one night, wey enter her house and nor gree comot till daybreak, enjoy the bottle water wah sell gee dem! *clickstongue*


*Na oyinbo call am customer follow up!*


Anor know why una dey worry sah go! Anor follow Nnamdi! Na yard i face! I wan go lem small Garri with my remaining Okra Soup!


This Nnamdi sef, after all him suffer, he still nor get luck with better women!*Hian*


I don kukuma collect Nnamdi number! *Popsgum*


Anor know as breeze go blow me one day, wah go jor press phone, wan confirm if na im get the Jeep wey pack for him Babe side around that kain 11pm?!


So i go fit ask him babe, if she wan buy her regular bottle water abi na Moort she want?! *sideeyes!*!


As good in law wah be!

18 comments:

  1. Sisi u be correct in law. Na real 🐐 power AC. That kind ac na straight catarrh e go dey give person

    ReplyDelete
    Replies
    1. Chai, nose go just block with ogbonge headache join

      Delete
  2. 🤣🤣🤣 Sisi abiakwa🤣🤣 Tuffy and Kaffy.

    ReplyDelete
  3. I for do shoki ah for you but ground no level,I pray for you today,as you make people laff ,may God send people from this blog to make you laff,amen

    ReplyDelete
    Replies
    1. Choi! Me sef wish to bless sisi o. May God answer this beautiful prayer. Never a sad moment here. Sisii for president🤣😂😂

      Delete
  4. Hahaha Sisi you no go kill person

    ReplyDelete
  5. 😂 😂 😂 Sisi I go like be your friend, Nigeria problem too much I need someone like you in my life wey go dey make me laugh my sorrow off 🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  6. Na correct customer service agent sis be o🤣😂🤣

    ReplyDelete
  7. sisi....your aproko na on another level. where Nnamdi wan see money buy jeep where u wan call am ask if na im get the jeep wey park for him girlfriend house front? Biko, leave that gal and face your front oh.

    ReplyDelete
  8. Sisi wey dey pop gum. You spoil small o.

    Haha@shisha mode.

    ReplyDelete
  9. Omo you know how to crank me up

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141