Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Imported Family Wahala

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, October 31, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Imported Family Wahala

WOOW!!!








Na who dey we SDK yard e?!


Stellajumbocampari...how market? I salute e!

I remember one time wey me and my roommates jor dey house.
Boredom wan finish us. Salary we never see! Na small rice remain for harsee...na so soba friend invite us for her uncle 70th birthday o.


We fly like rabbit, na so we land the venue ahead ahead to help them do some errands.

Where i sidon, after i don lem better Amala and Bokoto, wey my locomotive say na hia e wan park!

I been notice one woman, Aunty Simbi, wey strong face from the moment wey she arrive with her friends. She be the younger sister to the celebrant.


I see the celebrant senior sister Aunty Ayi and the wife of the celebrant wey dem nickname Aunty Gold as na Gold she been sell that time.

Na where i sidon i sight Celebrant Younger sister go pour soup on top caterer head and face! Chineke! Na wetin happen?!

The celebrant wife comot, signal her daughter to carry caterer enter Bq make she go baff and change!


I notice say celebrant wife dey avoid to go ask Celebrant younger sister wetin occur!

* Na person wey sabi find trouble be the younger sister!*

Celebrant Younger sister, tell waiter make she comot all the cheap wine wey dey her table, make she go bring champagne come to entertain her and her friends!


Na so Celebrant wife come the younger sister table say 'Simbi bawo ni?!' Choiiii!


Nna ehn, aneva see where tsunami dey occur for china, but the one wah see that day na perfect example!

Aunty Simbi say, i be your mate wey you call me by my name!

Celebrant wife say maybe she prefer Arike?!
Soo Arike bawo ni?!


Na so Aunty simbi fly table across, pounce on the celebrant wife!

Eeparipa! Party don scatter o! Wetin happen!

The brother wey dey sing for guests sef nor gree person hear wetin dey happen! Microphone for drum high pass the one for voice!


By the time celebrant sef go hear wetin happen, people wey wan settle kworeh don use head collect chair, bottle and plates!

Their grandmama dey inside house for sitting room. She dey there with her own friends as dem dey jollificate!

They manage carry the two women comot from under canopy go inside harsee to settle the matter!

Celebrant Sister (CS), say make the wife leave her brother alone, say no be by force to marry into rich family.

Celebrant Wife (CW), say the sister suppose don taya to dey repeat the same thing like faulty recorder!


CS say if not for her help, how the wife go even reason go abroad!

CW say that one na stale gist, no be she cause am make dem deport CS!

Na so another round of throwing shoe wan start!

CS say CW think say she nor know where she go tie her brother to marry him by force!

CW say how she take know the place, if no be her own wakawaka wan corrupt her innocence!

CS say which kain innocence, she say the time wey her brother travel for masters, no be belle CW go carry for another man, wey she carry her go one place to abort!

CW say that one no be news say even hubby sabi the gist already!

CS say oh really, hope say she remember tell hubby say na she scatter the relationship wey he get with the oyinbo lady wey he wan marry that time?

CW say big deal?! Any woman go do anything for love say all this gragra wey CS dey do, be like say she nor know say na adopt dem adopt her!


*spitouthottea!* You say wetin?!

CS say so CW wan come use mouth defame her family in public ba! Say she be legitimate heiress! Unlike CW wey na roadside dem dump her as small baby! *choi!*

Na so celebrant wey suppose mind him lane, carry hand pull wife say Baby lets go upstairs! Simbi omo ale ni e! *Meaning say Simbi be bastard!*

Choi! Na so Aunty simbi, carry stray bullet hit celebrant for blokos o!

She say hope say he don tell him wife about the twin boys wey oyinbo born for am in the abroad!

CW respond and say children are an heriatage of the Lord!Past mistakes are gone! She say make CS stop to dey chook eye for babalawo upandan!


Na im CS vexxx..she begin laugh say so Celebrant nor tell him wife say his last trip to the abroad last month, na to do naming for his newest addition to the oyinbo family! Baby number 5!

Chimooo! CW wan crase, but she dey try comport, her body don dey vibrate!

CS say ehn, she dey go babalawo because she need solution to her problems, she say at least na the same babalawo wey she carry CW go, wey dem help her clear road go abroad! Even though na jand as celebrant dey yankee that time!


She say shey CW wan deny say she go back to meet the Babalawo to beg make he join her by force by fire with celebrant?!

After Baba don tell her say celebrant love the oyinbo woman abroad!

CS say when the thing wey she dey put menses on top no gree collect menses again, shebi husband eye go clear!

*Woman wey don hit menopause, where she dey see menses?!

Celebrant don provoke! He rush wan hit him sister!

Na so their Mama shout say no way! Make celebrant nor ever raise hand for woman!

*Why this mama wan spoil film show like this!*

Mama say nothing wrong in wetin CW do, say aftoroh, since her son marry her, na from glory to glory!

Na who draw curtain, close window and off light?!!

The celebrant senior sister Aunty Ayi wey gather skushi pass the younger sister don enter house.

They say make non family comot parlour o...be like i wan go piss for their guest baffroom. *sideeyes!*


But as i open baffroom door, i see say their Grandmama clear me throat from distance!


Mah dey go me house jeje! Wey this geh wey we follow come?! Lota! Where dem dey?!

Soba! Soba! Small music she don fall for person husband lap! Anor get credit to call 911 o! Nor go hol wetin nor be your own abeg!




*Na wah so sister in law na em carry wife go where dem use juju hold her brother? so wetin come dey pepper her for body nau?

22 comments:

  1. Wahala family lol

    ReplyDelete
  2. Sister from the pit of hell

    ReplyDelete
  3. ๐Ÿ˜ณ๐Ÿ˜ณ๐Ÿ˜ณ this family is truly dangerfull

    ReplyDelete
  4. Na serious wa. Funny gist, yam pepper soup scatter scatter..abi no be so dem dey yarn am???
    Some people cannot do without babalawo.
    Jeeezzz Repent people, there is no solution Christ cannot give you

    ReplyDelete
  5. All of them fit each other, afteroh birds of a feather flock together, sisi carry go, you are too much ๐Ÿ˜๐Ÿ˜๐Ÿ˜

    ReplyDelete
  6. choi!!! See end time family ooo. Things are really happening

    ReplyDelete
  7. Sisi Weldon,a bigger shock dey come your way like psunami.money fall on you



    Oracle of God

    ReplyDelete
  8. See Stella o, dey Jamb question>

    My father's friend, na im sister carry woman go the church [white garment] where dey tied her brother. But on the condition that she pay her certain amount of money everyday. This is because, that my father's friend is a Citizen of the U.S. He was married to a Nigerian woman for 23 years , they had 4 kids, so when they divorced, she took everything, so he had to start all over again. This made him decide to marry woman and keep her in Nigeria. But he was taking care of the woman in Nigeria, put her in the house he built and took care of the woman's 4 children that she had with her ex-husband.

    That was how the woman fell in love with my Uncle and refused to give sister anything again. The sister jejely went to the church and they scattered what they did. Now, the woman no fit near my Uncle again. The pikin wey she born for him, she has to send someone to collect money for his upkeep, because Uncle no wan see her or else.....

    ReplyDelete
  9. Family of commotion๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚ you get luck say you didn't collect one chair for head

    ReplyDelete
  10. 14.25 Juju things. The woman na mumu she would have kept to the agreement

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141