Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponis Corner - Family Opera!

Pages

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, October 21, 2022

Sisi Senaponis Corner - Family Opera!

Ha!!!




Kpoi! Kpoi! Kpoi!

Stella-ferrari-oni-faari!..how de continent?! I hail!


Na who tie rope for gate? Una Goat don waka reach Junction e! E nor even remember wear shoe!

My goodfriend say her family na soap opera!


She say her Grandmama cause plenty problem nor be small!


She say the woman don carry spirit husband dash all of them ahead ahead before dey even born most of them!


She say the woman sabi jump from one gini gwanu to the other! Say if persin ask her, she go say na to protect her children!


She say out of 12 children wey Grandma born, na only 3 manage and stay! Two boys and a girl wey be her own Mama!


She say as their Grandma kpai like this, she don handover the 'thing' give her own younger sister wey dey with her for village during that time!


She say she sef begin suspect that her younger sister and her mother because e get how dem dey sleep for night! God abeg e!


I say why you nor follow dem sleep like that? She say bloodshortage go worry her for leg! *Kiikiikii...


I say na good thing say you sabi where you from come! So you go know where you dey go!
I say so why dey nor carry you go meeting since?! Abi space nor dey inside the bus wey dey go that side?!


She say she and her mama nor too gree like that! Say any small thing, her Mama go say she be 'ogbanje'!


Tor, i say so all of una be student, but na your school uniform different!


She say na when her spirit sugar daddy nor gree her see husband marry, she carry herself go do deliverance for that fire church wey dey Ibafo!


She say the night wey she from NYSC camp go the prayer city, na so her mama begin call per second, say where she dey! Where she dey! Make she better leave the place and come house! Come house for 1am?!


I say you sef, you nor learn anything for your own school?! *Hian*


I don follow this yeye geh and her sister, tanda for bustop wey we nor see bus! So she nor fit press her nose like Rentaghost or hang one leg for up, make all of us reach house! Nna ehn! Na treck we treck that night nor be joke!


She say she off phone for 1week as she dey the place with serious fasting and prayer!


She say na when she on phone, she hear say her Mama get heart attack for thesame night!


Na person wey never hear those prayer points go underestimate! You sef go dey pity the person enemy!


She go the hospital after 1week, her Mama say she nor wan see her o!


She say no problem she carry annointing oil come, Make the mama drink...I carry leg hang for up dey laff!


Fire dey burn person for belle, you carry petrol come say make she drink! Kiiikiiki...God abeg e!


She say her Mama shout for Nurse head, say make dem pursue her ogbanje daughter comot!*side eyes*


One of the nurse wey dey there, wey sabi, pull her for one side. Tell her say ehn, you know say na glasshouse she dey live! Say she nor suppose follow people throw stone for market!


My friend say to pray for house come begin confuse her!


Say the day she bring her suitor wey be prayer warrior come house, her Mama say lai lai o! Say the boy na occult! Say he wan kill her entire family!


She say na that period wey she decide to involve her uncles, make dem help her follow her mama talk as age nor dey her side again!


She reach her oldest uncle house, remain small wey she for use head collect chair and pot!


Wetin happen?


Her oldest uncle's wife drag her one side say, her second uncle wey poor pass rat, come back house say he find out say Grandmama carry him own glory give him senior brother!


So he carry cutlass come say he wan collect him glory back! Kiikiikii...God eee!


I say so how dem settle the matter?!


She say her own Mama talk say Ehn, wetin dey there?! Say Aftoroh na firstborn suppose get plenty money pass the younger ones.


So he go fit take goodcare of them! Say at least na still within the family the Glory dey work!


She say she stand there for her Mama kitchen, fear nor gree her talk pim!


She say so her second uncle that day come threaten say, shebi the senior brother don combine with their late mother and rob him of his destiny! No problem!


Na so the uncle say, make everybody get ready o!
As na all the Grandchildren's glory he go pack and give him own children!

She say nobody tell her when she run go church, go table the matter for God hand!


She say her own Mama sef talk say wetin consign her with pikin wey nor dey under her own covering! *sideeyes*
*As canopy wey she be!*


So na on her own she dey o! As she nor fit beat them and she nor still gree to join them!


Years don pass and na she convert that her Mama and younger sister to God!


Na when Airforce HQ begin ask her Mama to bring her for Asun and the Power of God nor gree dem penetrate! Na im AHQ almost collect her mama eyes as purnishment!


The younger sister collect promotion for their 'school'! She go jam person wey carry fire!


At the end of the day, na her house dey come begin find restitution and God!


She say her husband wey don turn pastor by that time, allow make dem squat for a while.


She say during that squatting period sef, the younger sister been wan attempt to konk her husband but na resetting slap Angeh give her! As her head nor wan correct!


I say that una Uncle wey dey gather glory nko?!


She say he dey where hin dey o! His children nor see front or back! Odi standstill!
*sins of the fathers and ancestors!*


*Choi! This God ehn...She say her Mama dey try convert her uncle to God! I say nothing wey God nor fit do!


Aftoroh, who could have thought that her own mama wey be former CPO *Chief Principality Officer* fit turn to Sanctuary Keeper!


Wetin God nor fit do, cantit exist!

21 comments:

  1. Wetin God nor fit do, cantit exist true true ooo

    Thank God for that your friend ooo

    ReplyDelete
  2. Things dey hapu for dis life sha. The name of Jesus be the greatest

    ReplyDelete
  3. Airforce HQ?🀣🀣🀣🀣

    Gifty

    ReplyDelete
  4. Many things are happening

    ReplyDelete
    Replies
    1. Them wan try God of fire? What God Can Not Do Does Not Exist!

      Delete
  5. This transfer of glory Na true o. It happened to me. I was around 8 years the time it happened. Mine was switched to one of my sister's who is our mothers favourite child. Some mothers are terrible.

    ReplyDelete
  6. Wow! Things are happening. The righteous run to God and they are saved.

    ReplyDelete
  7. God forbid, no body fit take or transfer my daughter glory or that of my unborn children. Which kain evul full this world self,tufia.

    ReplyDelete
  8. Nawah oo, wonderment πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

    ReplyDelete
  9. But why do these things only happen to Africans??? Just wondering.

    ReplyDelete
  10. Family wey winch dey na so e dey be, dem dey take am give their children as inheritance.
    God forbid bad thing

    ReplyDelete
  11. Hmm things dey happen.
    Pray always my people.

    I love love MFM

    ReplyDelete
  12. This switching of glory is real.

    ReplyDelete
  13. I laugh tire for this tori! no be small thing. Anyways God pass satan, anytime!

    ReplyDelete
  14. What God can't do does not exist.

    Chi anyi di mma.

    ReplyDelete
  15. Sisi nawooooh i don laugh tire jesusooooh
    Cpo🀣🀣🀣🀣

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141