Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponis Corner - Family Curse Palava

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, October 28, 2022

Sisi Senaponis Corner - Family Curse Palava

 Stellasparrow Dicaprio

Hahahhahahahahahaha



Kpoi! Kpoi! Kpoi!



Na who dey house e? I hail o!


Stellasparrow-dicaprio! How dey weather?! I salute o!


Na jeje I dey waka my own for road, dey go yard!


Remain small wey this fine jeep go clear him ancestors comot for road!


Hian! Oga na wetin hapun Na? Ano you before?


Na so he park come down, drag one fine young girl enter yard, go meet baba herbalist wey dey we side!


That jeep corss no be small! The man self dey smell of obodo oyinbo! *Choi! Money good e!*


I do slow motion enter yard, na im I set my antenna to begin download the occurrences!


Small time, person wey dey do skoin skoin don normal. I give them water wey she use wash her hand for aside!


I say Oga, hope no problem?!


As he wan tell me the matter, na im Baba clear throat, he say make dem begin dey go, as night go soon reach! *sideeyes!*


Na im I carry my fried fish and garri balance for front of my door!


I don know say one of Baba pikin na cat!


E nor dey use eye see fried fish! Be like say na wetin dem use swear for am!


He say Ha! Aunty na here you dey? I say Nooo, na my ghost be this, my original dey inside Radio!


He begin scratch head. Na im I say shey una visitor nor carry better condiments come give una?


He say noo, say the man case sef don taya him papa! As na every 6months he go dey carry the woman come!


I say na wetin do her?...he press pause, me sef begin turn turn my garri wey carry balanced diet.


I begin use hand arrange my fish inside bowl...


Na so the gist start...


Baba pikin tell me say, the girl wey kolo, na she even first find the herbalist. come.


He say the girl say, she wan marry one bobo, but the bobo no get money, and he dey like to attach with girls wey get money for campus.


Baba tell the kolo girl say, the boy family get curse wey dey worry them.


He advice her, make she go marry another person. But na everyday she dey disturb Baba for phone.


Longstory short, Baba do am wey the guy marry her and money begin flow for them. But na the glory of the kolo girl dem dey use to boost the something wey he do for them!


He say he nor know where the guy waka go with him Mama, wey dem tell her say, he must to leave the girl because she be badluck! *sideeyes*


Na im Bobo carry something, come house put inside cloth for the kolo girl. Na the thing come begin manifest wey she dey crase every six months. *Choi!*


I say I no understand?!


He say dem tell the Bobo for the place wey he go say na him own glory the wife dey use, so make he put the juju something inside her clothes, so he go fit collect him glory back!


He nor know say na lie!


The curse wey dey him family be say anybody wey get money or attempt to build house within that family, na one by one dem go begin die, starting from the oldest to the youngest!


Na so some people go warn the Guy Mama for village, say make she go cause confusion before she go kpai! As two elders don cross already!


I say, so as the lady don kolo now, wey all the money go stop, wetin come be the gain of the boy and his family?


The boy say the Bobo no know say na lie dem give him. As he don already start house foundation for village, na im the Mama enter the matter!


I say so this kolo woman wey fine like this, wetin come be her fate?


Baba pikin say, na to carry the woman go do deliverance for church!


I say Hian! A whole you, wey dey consume pass your papa, wey suppose be the ambassador for him juju market. You don port?!

He look me say 'Aunty you go give me fish abi you nor go gimme'? I look plate, my two fish don Go!


I say weyy fish? He say which fish?! He say fish wey I don Lem as he dey carry gist give me.

I say Mba! How I go chop fish wah go leave my garri?


He look me begin laugh, he stand up go backyard.


I stand up begin find fish inside my wrapper, under the Garri bowl? My mouth nor dey smell of fish. Na which kain drama be dis?!


Small time, Baba come out shout him pikin name, he say na who carry fried fish put ontop table?!

Haaaa! Na your papa born you true true!Well played! I go do my own! Irunmole help you lift my fish! 1-0! I dey come!

15 comments:

  1. Juju dey work for this people no be small. Sisi well done ooh

    ReplyDelete
  2. πŸ˜‚ πŸ˜‚ πŸ˜‚ The pikin don sapa fish πŸ˜‚ πŸ˜‚ πŸ˜‚

    Sisi I hope say you no go get temptation one day go meet baba for 'glory booster' laidis

    ReplyDelete
    Replies
    1. Honestly Sisi Pena is beginning to sound like she will follow their route.

      She sounds vulnerable.

      Delete
    2. πŸ˜‚πŸ€£vulnerable ke? This same sisi with coconut head?! You must be new here! Na stunch catholic o!Welcome to the yard.

      Delete
    3. Mama Twins don dey here tey ooo @anon 07:48 na you new here oo

      Delete
  3. They lied to the guy & that's the only way they can destroy the charm by telling him they used his own glory wey carry curse.let the girl spend quality time in the presence of God .let her go for deliverance for permanent solution.



    ORACLE OF GOD

    ReplyDelete
  4. Sisi you hear stories, you don't know when fish run hahahaha. Things dey happen but mumu go say na hallucinations dey cause am.

    Just be strong in serving God

    ReplyDelete
  5. no be small story be this one. I hail you Sisi.

    ReplyDelete
  6. When you dine with the devil so that you can have all your heart desires before your destined time, there is always a repercussion. That's what happen to the kolo lady.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Gbam! Nothing goes for free in the dark market of life. Trade by barter.

      Delete
  7. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚
    U dy listen to story , u no no wen ya fish miss

    ReplyDelete
  8. Sisi no go kill person wit laughter πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

    ReplyDelete
  9. Lol.....sisi u and this ya compound pipu sef

    ReplyDelete
  10. Sisi dey de kiaful with this your Baba for compound o.
    Na the slow motion got me
    Hahahahah

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141