Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponis Corner .- Defender Of The Helper..

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, October 10, 2022

Sisi Senaponis Corner .- Defender Of The Helper..

See Amebooo!!!




 


Kpoi! Kpoi! Kpoi! Na who dey we yard e?!


Stellapopsicle-levanilla! I hail o!

Yoruba pipu go say Nkan nbe!


I dey house say mah do sanitation small before i enter market!


Na so this woman rush enter our yard. She go Babalawo door begin shout 'Baba! Baba! Suffer don chop me o! *For yoruba*


Na so she dey vibrate dey go upandan!


I tanda well for window mah see wetin dey occur!


Baba comot, he carry her go backyard.


Anor even know say the bucket wah dey find since yesterday dey that side, na so breeze carry me go where anor know o!
I come remember say the clothes wah spread sef, need mah turn dem arand! *sideeyes*

Na so my antenna begin catch full signal. I say mah kukuma check the button wah jor put for these my skirts, if the buttons don dry! Kiikiikii...God abeg e!


Na im this woman carry talk give Baba say her neighbour for market disgrace am for public say she dey do juju! Say na why all her children nor gree comot for her house, even as they don overgrow!

Baba say ehn, shey you nor dey do juju ni?! No be true she talk?! Why you dey shame?!

* Awan laff throway leg, na im i remember say na breeze carry me come!*

She say Baba i wan teach the woman lesson!


*I been wan ask say which subject?!*


She say she wan make all the woman children wey dey successful for different cities come back house without anything! Chineke!

Baba look her, he don notice say i dey one corner dey rave the gist!


Na so Baba say Shiishii?! you don see wetin you dey find? I say Mba, e still remain*popsgum!*


Na im he ask the woman say wetin be the name of the woman?! She say na Iya Kudus!


Baba say him own Mama first born na Kudus, so hin own Mama sef na Iya Kudus.


He say make she go find the woman full name plus her mama name and bring come!


Aneva see person wey waka like speed of light like that before! Fiam! She don comot our yard!


I say baba this woman nor know you o!


He laugh, he say he wan make sure say i dey listen to hear the woman name!


Na why he ask if i don see wetin i dey find?! Incase the victim na my good friend before he go jam am like trailer!


*Na yard code be that! Baba dey reject some outside work if any yard person carry good reason give am!*


He know say people wey fit kidnap him children full yard! So he dey do the thing with sense, that one na before him anjonu begin sedi balabala inside him head!


I say i kukuma sabi the woman, be like say breeze go carry me reach that side! *sideeyes*


I comot dunlop, tie scarf, na so i stroll reach dem Mama Nedu side. Na same compound she been live with that Iya kudus!


I meet Mama Nedu she jor cook finish, na im she serve me Jellof rice and Goat meat! *choi*


We still sidon varendah, i dey use eye survey the Iya kudus side, e nor reach 20minutes wey that Baba customer come their compound!


She greet Mama Nedu, i back gate, face door so she nor see my face!


Na so she knock Iya kudus dem door, wey that one say wetin she want?! She block her for entrance.


Na so this woman hug Iya Kudus say why she just want make devil scatter their middle! Say she accept the way she correct her pikin, na out of love o! Eleeeehh*


And she nor even vex with wetin Iya Kudus talk say she don knack her children for housedoor!


She say she come apologise, make dem two pack their children put inside Yam flour wey dey inside basin *komo lubo!*


*anor know how dey wan carry grown children put inside basin, wey nor be say na swimming pool!*


Na so these women enter house begin laff kiikiikii...Choi! Enemy within e!


The Goat meat wah dey chop for fall, but because economy nor dey smile, i still geh strength hol my meat for hand!


Na im i download everything wah hear for yard give Mama Nedu o!


Aneva even talk finish wey Mama Nedu don disappear from my side, she go knock Iya kudus door. She say she wan quick show her something!


The other woman nor still know say i dey that compound!


Mama Nedu wey don tell me how the Iya Kudus help to rush Nedu go hospital when he faint for compound and nobody dey house.


Say na back Iya Kudus carry Nedu begin run for road like madwoman until she reach hospital!


Mama Nedu go Super that early morning and leave Nedu with her husband wey nor sabi anything about children! But he sabi do the do!


So na her helper! And she nor go gree make her own scatter!


Person wey nor fear Mama Nedu na learner!


That woman don over disturb satan wey he sef don comot hand for her matter!


Anor send her the message wey she go deliver o! Na as the pretentious woman sef wan still follow the two of them come Mama Nedu side!


Mama Nedu turn around,open mouth give her wotowoto!


She face the Iya Temi say, be like you nor know your lane! Your pikin thief! This woman come tell you make you collect wetin your pikin thief! And return to the owner!


Na im you insult her say na her bad mouth make all her children quick pack comot for house one by one!


And she do you BTS *back to sender!* say at least she nor resemble you wey nor gree make your children marry and comot house!



The Iya Temi say wetin consign Mama Nedu!
Say she go deal with her fa!


Mama Nedu laff! She look Iya Temi, tell her say if she nor do her wicked, she be bastard o!


Say Iya Temi must to carry her name go give Babalawo and do her wicked! *casted!*


Na there Mama Nedu begin mention her full name plus her Mama name join! God abeg e!



Iya Temi nor know say Baba nor go do anything, he fit jor give her flyer make she go share for junction as marketer! *popsgum*


Baba wey fit even give her fake something so she nor go carry her pepper body go another Babalawo!


Iya Temi nor know say that same Iya Kudus don carry that expensive New BATA shoe give Baba second born (Remi) when she pass Junior WAEC years back o!
Iya Kudus na birthday mate with Baba Pikin, so she just like the girl since small!


I hope say na Rat shit the man go give her, make she dey rub for body everyday enter market, until her virtual enemies die finish!Yeye woman!


Iya kudus nor understand wetin dey happen, she just dey turn like mortal for their middle say make dem nor fight! She nor know the main reason why Mama Nedu wan finish Iya Temi.


Mama Nedu wey use vigil finish her MIL when she first enter marriage!


The MIL and her fellow Air force go beg her make she forgive them!


Na im this one wey do neck like hyena wan go knack pigeon! Issoraii!


Na wetin dem dey call Alo rami rami! Like when thief wey dey bike, snatch person phone!


You know as the first 5seconds dey feel?! Exactly! Denial and Acceptance followed by premium tears!


Pikin wey nor know him mate go wash senior cloth taya!


Una winchy winchy senior for boarding haase! We greet o! Hope say God don forgive una?

As men never reason to forget e! Kiikiikii.





LMAOOOOOOOOOOOOOOOO

20 comments:

  1. Lol..

    Na always Mama name from dey ask cos them know say the palΓ© fit no be the real palΓ© base on paternity fraud levels..

    No be today men don dey raise pikins wey no be their own

    ReplyDelete
    Replies
    1. Jeez! see how you carry your wahala sef wan come spoil this sweet gist.
      you certainly know nothing. find beta babalawo make you ask am why dem dey ask for mama name.

      Delete
    2. You wey Sabi all the better babalawo why you no tell us the reason😏..
      Long mouth

      Delete
    3. But na true talk o. Dante l Neva reason am like DAT, why dem dey always ask for mother name

      Delete
    4. you are not a real man thenπŸ™„πŸ™„πŸ™„ a real man supposed know why babalawo dey find people mama name before them do jazz against them.

      Delete
    5. Dante, have you asked yourself why bank ask for Mother's maiden name?

      Delete
  2. 🀣🀣🀣🀣🀣🀣
    Sisi senapoeeeh

    ReplyDelete
  3. Ameebo wey tie wrapper come wear koi-koi shoe join....na God dey fight for him pple like this...sisi I hail o

    ReplyDelete
  4. πŸ€£πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚ best aproko award goes to Sisi

    ReplyDelete
  5. Lol, I first talk am say na that Super area your crib dey.

    ReplyDelete
  6. Moral Lesson: Be good to people.
    "Mama Nedu wey don tell me how the Iya Kudus help to rush Nedu go hospital when he faint for compound and nobody dey house."
    it is good to be good , see how Iya kudus' kindness is fighting off evil against her.

    ReplyDelete
  7. New words alert BTS - Back to sender. πŸ˜‚ That moment when thief snatch person phone ontop bike! Epic! This life ehn, it is good to be good o!

    ReplyDelete
  8. πŸ˜‚ πŸ˜‚ πŸ˜‚

    ReplyDelete
  9. Mama Nedu use vigil finish MIL and her fellow Air force (witches) 🀣🀣🀣🀣

    ReplyDelete
  10. See gist oooooo. Mama kudus good deeds is speaking for her

    ReplyDelete
  11. Na wa wetin pesin no go see for this life😞

    ReplyDelete
  12. Sisi, ebi like your antana long pass MTN mass na im mek you dey hear quick, network no brek atal atal πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜˜πŸ˜‚πŸ˜πŸ˜πŸ˜πŸ˜€πŸ˜ƒπŸ˜„πŸ˜πŸ˜πŸ˜Ž

    ReplyDelete
    Replies
    1. MTN dey learn work o.🀣🀣🀣

      Delete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141