Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Mentor Collect Woto Woto

Advertisement

Monday, August 01, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Mentor Collect Woto Woto

 Haaaaaaaa this one serious oooooo!





Kpoi! Kpoi! Na who dey house e?



Stellablingbling, how de weather of the overs?! I hail o!

Wetin Akara nor go even see inside Akamu?!


Na hurry I take waka as belle begin turn me, I say make i quick reach yard go offload!


Na so punch begin fly left, right and center! Mama Nedu begin hold one woman wey come do James Bond for her shop!


You know say this Amebo thing na calling, na so my belle jor settle to upload the occurrence!


Broda Dele and his friends help to separate the women as Mama Nedu sales girl dey wipe the unknown woman(Mentor)! I never see where person dey use cane flog grown woman for buttocks, the scenario dey too funny abeg!


Everything settle small, I say wetin hapun?!


Mama Nedu say the Mentor woman na wicked person, say after the woman carry her sales girl to mentor, wey even the girl dey do well. She join choir for her church, finish her final exams, assist the woman with house chores, etc!


The Mentor woman son come from obodo oyinbo, he like the sales girl and say na she he wan marry!


The Mentor woman say Tufia! Say the son cannot marry the Sales girl!


Wetin be the reason o?! The woman say the girl get bad past! Abeg who nor get bad past?!

Even Nigeria still dey 'filanda' inside past and present past!


I say but the sales girl say the woman na her mentor, the woman suppose happy say her 'metorletom' wey she train all round, behave well wey her son come see her as wife material.

Na better investment be that abi how una reason am?!


Na as the son go do visa arrangement for the girl, put her on monthly allowance say she go further her education do masters in the abroad!
Na so the woman hear, so she come threaten the sales girl for Mama Nedu shop!


She nor know say the sales girl sef don ready the woman. She reboot the crase wey mentoring don comot before! She wipe the woman beating like say na she inflate fuel price!


The woman enter her car with shame, she drive comot! The girl call the bobo, that one begin beg her say make she no vex and she for nor fight him Mama.


The Sales girl come download give us say, the Bobo like to dey collect from 'backyard', say he beg her make dem at least marry and born, and she can remarry after she don settle for the abroad. Just to give him mama grandchildren.


I say Nna ehn, this life no balance! So if to say the woman no carry aggression and threats give the sales girl, she for even hint her about the arrangements, unto say her Golden son follow Gabriel relate! But as the woman wan make am be like say na her son holy pass! Na wotowoto she come collect inside Market!


I say so wetin be the conclusion na?! The girl say the Bobo still want to proceed but she no wan do again!


As children matter go enter and she nor want anything to join her with the mentor woman again! I say so wetin be the thing wey she tell the mentor wey make her tag her as unfit?!


The Sales girl say na when she small, one reverend person molest and rape her, she carry belle at 14 and abort the pikin! I say so na the sin wey you commit wey she wan make heaven relocate come sapele be that?!


Nna ehn, this life and our pipu!

24 comments:

  1. Hahahaha golden son follow Gabriel relate 🤣😅🤣🤣😅 who do you sesenakpo

    ReplyDelete
  2. Madam mentor no go get grandchildren in long time.

    ReplyDelete
    Replies
    1. It takes five minutes max to make a baby. Mother and son will come to agreement and find a woman who's interests also align. There are women who are attracted to women but are responsible and want to raise a family. Love isn't hard if you don't complicate it.

      Delete
  3. Na why e no too good to dey talk your past give person.
    Abeg that girl shuu kuku continue with the arrangement joor,Make that her mentor go hug transformer.

    ReplyDelete
    Replies
    1. The woman is right. The fact that she even fought someone older, who's mentoring her shows she's Everything the woman feared and more. Who does that? Did the son force himself on her or is her own backdoor her main door??
      Dunno why all of you reason like Buhari

      Delete
  4. 🤣🤣🤣 Heaven relocate!!! You are something else.Lol

    ReplyDelete
  5. You really sabi this work o.. thanks for always making me laugh

    ReplyDelete
  6. Sisi thanks so much for this post. May God strengthen your amebo antenna, may you never lack ink and book to for take write. Amin

    ReplyDelete
  7. Sisi Sena like gist. Mama think say her son na prize! Heaven no fit relocate abeg!

    ReplyDelete
  8. Amebo na Calling...people no no.hahahah

    ReplyDelete
  9. Hahahahaha.. so mama no know say na epp sales girl want epp their family

    ReplyDelete
  10. i enjoyed reading dis....sisi sena, i carry yansh for you ooo

    ReplyDelete
  11. Irrespective of whatever, she had no right to fight the woman. Ill.mannered girl.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Ok so she should stand and be collecting slap and not defend herself. Shift abeg😂😂

      Delete
    2. Thank you.

      Delete
  12. Sisi why are you like this ehn. 🤣🤣drink water while reading at your risk o. I choke no be small o🤣😂🤣

    ReplyDelete
  13. Amebo na special calling o
    No be everybody fit do am o

    ReplyDelete
  14. You have found your calling Amebonawork

    ReplyDelete
  15. I no dey understand myself lately. Cos anytime i see Sisi Senaponi gist, i must sit up and adjust cloth before i read 🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  16. Amebo na work o😂😂

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141