Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Parental Curse

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, July 08, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Parental Curse

 Sisi and Amebo!





Kpoi! Kpoi! O...Na who no dey house e?!


Stellamamalicious....how de empire?!..I salute!


Na me and landlady sidon for yard. Wey she carry gist give me!


She say her senior sister marry correct man but, she no see pikin born. The man begin do as man go begin do! With the pressure from him family sef join! *drama!*


Small time, the senior sister begin pray and fast but nothing dey work. People offer to carry her go Mountain and valley. She refuse say she no dey go May her husband no go vex for her!


Landlady say na so she wey be the younger sister, follow her own bobo go him church as them dey do programme . She say na there dem carry message give her for her senior sister!


Landlady reach house, with her big mouth, tell her sister Say, them say na their Mama get hand for the barrenness!
The senior sister Say na lie! So they plan, go meet their Mama for house.

The Mama say na true..


The senior sister nor even get patience her the remaining story Na so she faint yakata for floor!


Na as dem pour her water, wey she wake!


Na im Mama narrate give dem Say, they get one family curse say the Ada no go see better man marry!
Say even if she marry, the man go either be drunk or one useless person!


Na so their Mama say God forbid, wey she find 'way', to make sure say her first daughter marry, 'even if she no go born pikin until after 15years'!


*this na wetin yoruba people dey call eskelebe..wey no lebebe!*


Na as dem help me close my mouth, na im I realise say e dey open since!


I say, How old be your senior sister when she marry?! Landlady say na thirty two. I say so plus fifteen! Na until Fourty-seven years old before she go born first pikin?! *Odi wonderment!*


So wetin be the guarantee say the pikin sef go wan stay this wicked world?!


Landlady say where she even go 'knack' pidgeon for Landlord head, they don tell her already say, she no go smell pikin between her and landlord But say she go get peace of mind!


I look am, look again... Abeg, una don see where terrorist dey get peace?!


Landlady say, she wey don born three pikin keep for village. *like say na gala, wey person buy, keep inside traffic!*


And landlord prodigal pikin (Bobo) don come back house plus the unclaimed ones wey he scatter put outside. Landlady say she nor dey worry her sef o!
She say as she dey so! If Landlord do anyhow, na to go re-knack the pidgeon because na him be the bone of her bones! *abi thorn of her thorns*


And she say if Bobo dey reason to inherit the yard, say na wetin Adort dey use pluck Mango for Backyard, she go borrow am!


I don forget say I get Bible study. I dust my wrapper enter house!
*Devil no do reach this one inside Bible.* Biko!



10 comments:

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141