Ah this one hot!
Kpoi! Kpoi! Na who no dey house e?
Stellakokolet 1,2...how every every?
Nne, na one matter wah remember, I say make i gist una.
We get one family for our area that time, the husband and wife born 3 boys and 1 girl.
They get one Aunty Maid wey almost be like same age with the wife.
We first think say na their relative all those times. Small time we realise say the woman get mental problem as she go just dey inside house or sidon for balcony dey look into the sky.
If person greet her, she go respond but her thoughts and words nor dey too correlate.
Na the day wey the wife and her best friend fight one horrible fight on top Aso-ebi, everything come to the open!
The wife wan carry Aso-ebi for her Mama birthday sell at party price give her bestfriend wey carry her go where to buy the material inside market! *sideeyes*
The bestfriend vex serious for the wife as the friend come even hear say the wife talk say if her best friend nor like, make she nor come the event. Aftoroh, she nor kukuma dey same financial status with her!
Na so the bestfriend open fowl blokos o! She storm the compound that early Morning! She begin confess like witch wey white garment pour prayer water!
She say the 'Aunty Maid' wey dey wife house no follow them relate at all. She say na the Aunty Maid born all those children for the husband as the woman nor kukuma get womb to born pikin!
Madam Bestfriend say the wife come use juju hold the woman for house, make her eye no clear to claim wife position or carry the children and run! Choi!
I open mouth I nor fit close o! As we tanda for balcony dey watch the drama. Nna ehn, android phone never enter that time! If not, matter for go viral!
Best friend say Wife turn the Aunty Maid to mental case so she nor go remember anything about herself or her relatives. She say as long as Aunty Maid dey that house, the woman and her husband go dey progress and get money!
Choi! This one na real yam pepper scatter scatter!
E nor too teh wey elderly people gather for the compound pursue the best friend comot for the side as she really wear knicker come fight, but the wife just lock window and ignore her.
Nna ehn, the matter come get as e be that time, the wife nor follow anybody relate again for area o! The husband wey sabi travel sef nor too greet anybody for street.
They just continue to live quietly for so many years. I nor know wetin come hapun to dem as we first dem pack comot for area!
Hmm...things dey hapun abeg!
Things dey happen true true
ReplyDeleteNawa oooπ³π³
ReplyDeleteHmmmmm jesussss what did I just read π³. So things like this still happen π³.
ReplyDeleteYou write so well ma , I enjoyed all the raw pidgin part , weldone
Things they occur oooo...
ReplyDeleteThis life ehhh!
ReplyDeleteThe wickedness in this country eh eh na only God go fit help his children. People find it difficult to collect little gifts say hearts no dey pure again
ReplyDeleteO my God
ReplyDeletePeople wicked sha
ReplyDeleteπ♀️
ReplyDeletePlease can you for once come with stories of what the Lord is doing, not always juju, juju
ReplyDeleteDrink agbo for your bitterness o Anon. 1bucket per hour. Welldone jare sisi! Eye-opening gist! Things are really happening inside life! God help us o!
DeleteYou can skip her stories na,no be by force to read her beautiful,fun and eye opening write ups. Hey Sisi,you are loved.
DeleteCrazy things are happening π³
ReplyDeleteNa waa for wasce
ReplyDeleteNawao,na where person waka reach e dey see stories o. Things dey happen
ReplyDeleteThings dey really happen. Na so we dey look one oga for our street wey im ijebu wife don padlock im brain. One day one day, all go spoil and he go free
ReplyDeleteWe get one for our compound too. Until the day God will destroy the padlock she used to lock her hubby! Sisi deserve award and gift for this blog o, Stella! Sweet interesting and funny gists helps depression!
ReplyDeleteThings dey happen oooooh
ReplyDeleteNo be today nyash dey back.
ReplyDeleteThings dey happen ooo
ReplyDelete