Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Thief Dem Attack Ashawo Thief Money And Phone

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, July 08, 2022

Pidgin Post - Thief Dem Attack Ashawo Thief Money And Phone

WHAT!!!..... so Ashawo no fit work in peace again?






For news for this side (TV News) dem replay scene of how thieves take attack one ashawo wey dey do her work jeje... Sebi una sabi say ashawo work for Europe na legal and dem dey pay Tax? Ehen so dem dey feature dem sometimes for news if the story sweet.


As the story be, the ashawo say she get one young customer and she charge am 100euro, the guy come check pocket, say e dey come make e bring money join from motor, so as he go motor, he return with other people, dem enter and dem beat the ashawo well well and nearly stop the air wey dey flow enter her lungs....

As dem dey go, dem carry her three thousand euros, carry her Jewelries and her phone join... As dem go, she quick call Police and Police catch two of the thieves e no reach two hours sef.

Even Ashawo Lawyer wey dey on Holidays, respond say em client must get Justice...

The problem now come be say Ashawo say fear no let am fit work again!

9 comments:

  1. Ashawo work no easy. Risks include.. Murder, rape, robbery, STDs, pregnancy, job loss. Etc

    ReplyDelete
    Replies
    1. Those who believe in violent sex, fetishes then spiritual robbery nko?

      Kai

      Delete
  2. This is the hardest work in the universe. You daily deal with human of all class and spirits.

    ReplyDelete
  3. Aside Ashawo work, all work get risk
    Lolz

    ReplyDelete
  4. Eeyahh...but why is she walking around with €3k. Me i dont blame ashawo ooo. Na condition make crayfish bend

    ReplyDelete
  5. Nigeria is one of the highest exporters of asewo globally. I wonder why they don't add it in calculating our GDP

    ReplyDelete
  6. Justice for olosho....stupid men

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141