Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - For Naija 'School Safticate' Just Dey Loss Upandan...

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Wednesday, July 06, 2022

Pidgin Post - For Naija 'School Safticate' Just Dey Loss Upandan...

 This post nah to address all the people wey don dey cry say dem school 'Safticate' don loss....My question be say, if your paper don loss, how you take become governor, Minister, Senator, councillor, how? abi dem no need paper for those posts?






I no kuku talk say anybody dey lie, this post nah how we go take make sure say e no go happen to others in future, where people go hide dem paper make rat no see am?.. Abi no be rat eat the ones wey dem say e loss?

Another just talk recently say na em score the highest for the whole Naija, all that na empty boasting, how we wan take cross check am? Oga hope all your family member wey you don push enter politics no go tell us the same story later ooooh.

Naija Politicians na scam according to internet people...

6 comments:

  1. Yeye people! Nz cause the country no get rule of law

    ReplyDelete
  2. Its an eye opener for all, get your pvc and vote the only qualified and competent candidate that his certificate no loss, Labour Party, Peter Obi.

    ReplyDelete
  3. Wetin concern agbero with overload
    Politicians no dey go school,Na dem talk say laslas school na scam,look how far asuu strike don last,They don't give a sh!t.
    Stella I suggest they hide there imaginary certs inside their yansh,abii rat go chop am??

    ReplyDelete
  4. Na so we see am ooo🙄

    ReplyDelete
  5. This country na cruse na..anybody fit do anyhow go free..

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141