Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, June 03, 2022

Sisi Senaponi'sCorner - This Life No Balance Aftoroh

 This life na wah!!!





I hail o my pipu dem dem!


Stelladicaprio...how markeit?! I salute o!


Hmmm....This life na wa!


Na so I climb okada see my long time customer (pamela) wey I been they sell market to back in the days. She wave me as I pass, na hurry I dey that day.


Na so I remember the time wey I go their compound to supply Pamela and her neighbour(Augusta). I ask after Augusta, Pamela tell me say Augusta dey inside house but the two of dem nor dey talk!

I sell Pamela market finish, I go knock the Augusta door. She say make i open, as I enter, she dey for bed in one position!

Wetin hapun? Aunty Ogor?

She say she get boil for the underside! I say undergini? How he take hapun?

She say na just small infection from her Bobo. Plus she come get fever join.

I say make she go hospital. She say Mba!, she don Google wetin she fit use for wetin dey worry her. She carry paper give me to help her buy the things for chemist.

You see that her bobo, na him rent and furnish the selfcon for her. He dey travel, go work for another state and visit once in a while. I never see am before that time but na gist I hear from Pam.

Anyways, I say make she gimme money make I help her buy the antibiotics, Morning after and pregnancy test kit for chemist. The one wey she go rub and the one wey she go put for mouth and inside the wetin wetin!

Fear even begin catch person as self medication nor good!


Na so I carry keke go, as I dey come back with the melecine. Na so agboro stop the okada, dem begin lobby on top shikini money o! Hian!


As I see say time don dey go, and I still get plenty things to do for house! Plus okada almost throway me inside gutter as he dey dodge agboro wey wipe am cane for head!


I still dey think how I go see another okada under the hot sun. This okada man no go refund me my money as he use am do change for person wey he drop for chemist, before he carry me!

Na so I see Augusta brother wey sidon for front inside korope. I quick wave am down. I carry the melecine inside nylon give am, make he help me give him sister.


He open the nylon look me, he ask if na for Ogor or another person? I say na she carry money give me. I even tell the brother make he buy fruits go house as Ogor nor too well o!


Na so I leave okada wahala begin leg the road go my side!


Na like the next weekend wah go their area, I jam Pamela for salon. Na that one carry gist give me say no be Bobo give Augusta any yeye infection!


She say na so so different men she dey carry come house every night! I say Udonminit!


Pamela come tell me say, the melecine wey i carry give Augusta bobo even wan scatter everything but na she go pretend like say na she get am, no be Augusta!


Say Augusta bobo begin warn her against friendship with him babe! Say she, Pamela na bad influence o!


I say I nor understand! Which bobo? Na her brother I carry melecine give na!


Pamela say Mba! Na the Bobo be That! 


Eleeeee!


But na who she tell me say he be, the day wey she escort him comot, I come dey wait her for balcony see one redhead older man arrive, she come tell me say na her Uncle be this one and na her brother just comot! Hian!


Family wey brother and uncle nor sabi themselves! *sideeyes*


As sun too hot and bright that day sef, remain small wey uncle wan tumble for staircase when he comot dark glasses. As na night he dey waka come that side! Bright light nor too master am!


You know say even bible talk am say workers of iniquity inside the night...odi something something ! *sips water* I nor go Sunday school the day wey dem teach us the chapter complete. Make una nor vex!


Less than 3weeks after, Na for mass I see person with wedding invitation, I look am, recognise say na Ogor and her brother, sorry her Bobo wan wed!


Pamela say Augusta don even carry belle! Na the bornday the Bobo go fit put two and two together. I doubt say he even get sense like that anyway! *He too mumu abeg!*


Person dey follow Oracle share woman, he nor suspect anything! He nor dey see masquerade for sleep, abi bushbaby nor dey wipe am mat for head?!


If devil wan come give her souvenir, na her 'Uncle' the pikin go come resemble!


Aftohroh, Oyinbo kukuma say Apple nor dey climb staircase pass where im Mama hang am Except na mango e be! *Clickstongue*


Wey this pikin wah send pure water! Oche! Oche! Nor go carry my money buy sweet o!








17 comments:

  1. Sisi u 2-much. DNA matter go solve that one aftoroh.

    ReplyDelete
  2. I don dey laugh for office o like mumu. So you dey miss Sunday school service
    Ada Agu

    ReplyDelete
  3. 😁😁😁...Nice one

    ReplyDelete
  4. LWKMD!!!! no be ya fault, Ogor talk say "the bobo" na ein brother, how you for take know say na ein boyfriend. iss well, even in da well.

    ReplyDelete
  5. Bush baby no dey wipe am mat killed meπŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚...biko o. Just too funny

    ReplyDelete
  6. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚.

    ReplyDelete
  7. Ha, for once i could understand most of what you are saying. Me wey sabi waffy pidgin bin dey fall my own hand, now I got it on one read. Mama, I made it!

    ReplyDelete
  8. This woman e be like you get degree for pidgin literature πŸ˜…... Nothing do you jare

    ReplyDelete
  9. This is my best on this blog now

    ReplyDelete
  10. πŸ˜‚πŸ€£πŸ˜‚πŸ€£πŸ˜‚ life no balance. Set awon sidechick to Irunmole.

    ReplyDelete
  11. Na d 'aftohroh' part I been dey look for from the beginning πŸ˜„πŸ˜„πŸ˜„

    ReplyDelete
  12. You are hilarious aftoroh😁🀣

    ReplyDelete
  13. I love reading this corner hate, ride on your pidgin too Make sense

    ReplyDelete
  14. I dey always shake before I read her column πŸ˜‚πŸ€£πŸ€£

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141