WOW!!
I hail o, fellow yard pipu dem dem!
Stellalucious...how empire? I salute o!
Mama Nedu travel come from village, I say make i go greet her for house.
I reach, I see one Aunty-visitor wey begin give us sweet gist. She say her sister husband too travel abeg!
He nor dey ever remember birthday or wedding anniversary as she never born give am!
One day the wife dress for house say make she carry herself comot, go watch movies, relax and feel young again as na her 40th birthday.
As usual Husband don go oil rig! *another wife and kids for Umuahia*
* Na only God kukuma sabi the real people wey dey go CRUDE oil rig. Na the rest know which one dem dey go!*
Na for cinemas mall, wife meet young Bobo, they begin to do undercover romance. She spoil the young bobo with money no be small.
One day wife comot go club, she come back house without car and wig plus one leg of shoe! She say armed robbers stop her for road! Husband no dey town, he say when he return, he will handle it with the police.
The husband younger sister wey wan graduate from Uni come visit them for few days. She come block her brother wey promise her money for her graduation party. As na the same evening the brother go arrive Lagos.
Sister in law carry new car come house, begin tell her brother and the wife about her Bobo wey don propose to her. Say he wan even send her go Dubai.
The next morning, husband go outside, come back inside again. He ask wife which time police return the car wey dem thief?!
Wife confuse, she say she never report give police, say nobody bring any car come house o!
Sister-in-law come parlour hear their dialogue, she say na she get car o! Say her Bobo give her as birthday present.
Husband say he recognise the car, even though the plate number don dey customised. The window too come dey tinted.
Wife tanda she no put mouth, to avoid quarrel with the sister-in-law. Husband invite him car dealer, that one come confirm say na the car!
*fear those dealers abeg, dey sabi their merchandise even inside Tsunami sef*
Sister-in-law invite her Bobo come house, husband don position police, dem arrest bobo, go lock am for cell.
Bobo say na Mutua friend dash am the car.
*I say why he nor call Mutua make he bring him friend come clear am na!?* He hang sense like network failure! *clickstongue*
I say which work Bobo dey do? Na gologolo jingo him be! *Another oyel rigger!*
Sister in law don disown brother say, he disgrace and detain Bobo wey she wan marry!
Bobo carry lie give Babe say he buy the car! He reach station say persin dash am! Him friend wey he wan robe as mutual, that one deny with proof!
The Aunty visitor say, her sister confess give am later later Say, the night she go club with Bobo.
Bobo ask her for urgent 'hooge' money but she no get, and he no wan wait! *Wedding money*
Na as Wife carry Bobo go drop for him house, wey dem begin do 'tins' inside bobo house, some girls burst door enter house!... She say dem beat 40 comot for her body! Even dey call her husband snatcher! *bobo Na scammer!*
She run comot to save her life come house, leave the car there! Bobo no bother call her or pick call at all. Na days later the SIL carry the same car come their side!
Bobo don use him own hand destroy all evidence linking him to Wife for phone, he dey reason say, he don chop clean mouth!
Thinking say fear of affair exposure no go gree her report give anybody!
Choi!!...this one na case of trap catch the owner!*
Hmmmmm interesting
ReplyDeleteCar dealer no do any magic, husband for just check old papers of the car and new one wee de inside. The Chasis number go be the same thing.
DeleteWhat sort of story is this biko??
ReplyDeleteIs it the oil worker's sisters boyfriend that stole the car or wife's boyfriend?
ReplyDeleteThis one hard me o, used to think I sabi pidgin.
Yes and Yes...
DeleteIf Devil, that ancient serpent called satan, the dragon, want to set a trap for women, the bait is car and money!
ReplyDeleteEven after the dude was busted as car thief, the girl dey disown her brother say he lock up person wey she wan marry?
😮😲
And if Satan sets trap to catch men, what will the bait be?
Deletebobbi
DeleteStella, I know you say that pidgin is sweet but for the sake of we the non nigerians can we have these posts written in proper English too? I know I can just ignore the post but I want to know what the poster is talking about and since I don't know pidgin is hard to understand.
ReplyDeleteyou like amebo well well
DeleteNot judging, I like gist too and visit Jamaican blogs but I don't understand patois so I know how u feel.
I accept cars, dollars and kidneys for my interpreting duties. Here we go:
An oil worker who works far from home, is expected back home
his wife is a ttc who just had a bday and dressed up, went to the movies, trying to make herself happy
he has a secret second wife who has children
his sister is in his house to ask for money for party
his sister's bobo =boyfriend stole his car and refurbished it and presented it to his sister as a gift.
his car dealer identified the car gift as the stolen oil wokers car
The rest na exaggerated exclamations
I understand pidgin but this one hard me
Eayah, don't worry we go tell you the story
DeleteWhy do I pity the cheating wife in this scenario... Cheating never ends well Sha. As for the SIL she must be really childish not to have seen the handwriting on the wall moment brother said Car was suspicious.
ReplyDeleteNa wa. Thief steal Thief. Women and ashewo na bread and butter
ReplyDeleteNawaooooo,things are happening.
ReplyDeleteWife Mumu, husband idiot, sister in law, ode. So she still wan marry the nkpi? Her case is bad. And the idiot boyfriend thought the car will just go like DAT? Police hand Neva touch am well
ReplyDeleteHmmmmmm
ReplyDeleteThis story na wa o,all of them na foolish people.husband leave car for house,the sister bring am come back say na bobo buy am for am.The husband nor fit code say na wife dash am to bobo?......... Josaria
ReplyDelete