Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Scape Goat

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, June 13, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Scape Goat

 Wahala be like bicycle!!!






Kpoi! Kpoi! Kpoi!...Na who dey yard e?


Stellatropicana...I greet o!

So this very fine family dey live for our area that time. We dey see the wife and children for mass.


Small time the husband no too dey come church like before. Wife no dey give room for anybody to dey probe her personal life.


Small time na so we hear say husband don carry belle give another woman for Lagos.
How manage?! After plenty children wey dey don born!


The first wife vex no be small. She carry her children comot the house, she go stay for Abuja with her family.


Na as she come house one day, her daughter say she wan tell am something.
Pikin say she follow her papa go to greet grandpa one Saturday evening when she no dey house.


The daughter say she hear grandpa dey ask their papa which one he don decide to donate.


And their papa say he never decide. She say na so the grandpa say, he better decide fast before all of dem go begin die one by one.


The first wife carry phone call her mother wey be prayer warrior. Her mama confirm give her say, she sef don dey see the signs but she no know how to narrate give her.


Her mama say, he get reason why the husband go give person belle outside o! Say make she dey patient with am. As na genuine love he get for Her!


The matter confuse the first wife more, na so she carry her children keep with her mother wey she come Lagos to confront the husband, as he don already begin camp with the mistress.


Husband tell her say he don even pay planner wey go arrange their small wedding. He say he go marry the mistress and live as a family!


First wife vex with tears come back Abuja. No be until her mother carry her go church, wey she begin fasting and prayer!


Na so she dream o! She see her husband father dey tell her for dream say, if she no want make her husband donate her own children, why she come dey vex say he go bring pikin come from outside?!


Wife say she wake up, begin plead the blood of Jesus! Na that time her eye clear say, the kain family wey she enter na battlezone o!


She come begin dey pity the mistress wey no know say na contribution dey go use all her offspring do!

Husband tell first wife say na her choice to either come back to their home, join him in Lagos with the mistress or remain elsewhere but, he will fight to collect his children!

Ololololo o! 


hmmm...I hear say she carry her kaya and children, move enter back to their home! She no bother turn face ask, or look wetin dey shele for the other side o!


Hmm...na only God fit comot the new wife from the kain bondage wey she carry her legs waka enter o!

13 comments:

  1. Even the first wife is not safe. Her kids are not either. Why will a God fearing woman be married to a ritualist. All in the name of patience

    ReplyDelete
    Replies
    1. Patience? More like pay.

      Delete
  2. Kai na wa ooo. That is why you have to be in Jesus Christ if you want to win. The world is already wicked. Too many demonic people in this world

    ReplyDelete
  3. So she go back to dat her ritualist husband with her children after the revelations kwo? And her fake prayer warrior mama nor talk as per say pepper gallant wey all of dem dey see chop freely? For their analog mind now, the new wife no sabi anything ba? I laugh in Swahilli. Na turn by turn.

    Abeg, it's the different ways you hail Stellz for me. The other day na Stellacapuchino. Better crase dey your oblongata Sisi. Keep it up babe. Your amebo dey ginger our ministry.

    ReplyDelete
  4. Why be say immediately i see sisi senaponi, na so i go adjust, siddon balance well before i read 🤣😂🤣😂

    ReplyDelete
    Replies
    1. 🤣🤣🤣🤣

      Delete
    2. This comment has been removed by the author.

      Delete
    3. Are you me? I balane well to digest her article

      Delete
    4. I dinor know pe I'm not the only one that balance well and avoid eating or drinking anything while reading sisi. The other day that's how I spilled out coke on my innocent colleague ontop laugh o! You too much Stella.

      Delete
  5. This is a gentle reminder not to think anybody's life is better than yours or to look at any couple as being ideal and whose relationship you would love to have. The way some ppl view and treat children in this world is heart wrenching. Too much wickedness I tell you, too much doled out to innocent children who do not have the strength to fight back or protect themselves.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141