Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - The Introducer.

Advertisement

Friday, June 24, 2022

Sisi Senaponi's Corner - The Introducer.

 Sisi and amebo nah like 5 and 6...




 
Una doh o! Na who dey house e?!


Stellakokolet...how the terrain? I hail o!

Na salon I dey wey one customer wey comot from drier, pick her phone call. She begin carry report give person wey be her sister.


Na my turn to wash my hair, but I use style tell the hairdresser make she gimme 5mins as I dey find wetin no loss for my bag.
* too much sense nor go kee persin abeg*


To even make matters easier, the hairdresser ask the woman say wetin hapun? I balance to hear the memorandum! *kiikiikii*


Customer say, na so she carry Man wey she 'like' introduce to her female friend. Small time,she hear say the two begin do 'underground' tins!
So she don decide to send boys to beat the female friend. *Hmmm*


Hairdresser say, that your friend na bad person o! So she dey knack your 'husband' for your back?!
Customer use bad eye look the stylist, use style hide her left hand (with ring) under towel!

Customer say, the man no be her husband!
She say na her 'male friend' from some business wey dem dey do together!


I say aunty abeg no vex o! That your friend na evil person o!

*Yinmu, Na just to caress her ego*.

I say he no matter! Why your female friend go do that kain thing?! When she get husband for house, go dey knack another man outside!


Customer, carry another bad eye gimme! She say the female friend never marry!

I say even worse! Na bitterleaf she be! Why your female friend wan scatter the married man house?!

The customer look me and stylist. She say the male friend never marry!

Me and stylist look ourselves!

Na im I say! He nor mean! At least if the two single people wan knack or marry, they suppose first tell you, wey introduce dem abi!? Incase you get interest?!


The customer say the two friends don sabi demselves from University. But na she just reunite them again.


*be like say I get wetin I wan even go do for house*

My customer quick wash my hair, carry dry towel put for my neck, I tell am may she come dry my hair, may I do, comot biko! Hian!



Hahahahahahahaha so nah the Introducer be the person wey suppose leave the man and her friend alone...

17 comments:

  1. Abi ooo Stella introducer na the ashewo gangan πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

    ReplyDelete
  2. 🀣🀣🀣🀣.. Shameless woman

    ReplyDelete
  3. She ended up cobalizing herself🀣

    ReplyDelete
    Replies
    1. Lol KrytiQ, did you attend Queen's college Lagos?

      Delete
  4. Gifts for hairdresser's station no be here.

    ReplyDelete
  5. 🀣🀣🀣🀣🀣 I confuse too o

    ReplyDelete
  6. Married woman wey dey cheat without shame. Tufia

    ReplyDelete
    Replies
    1. Sisi u need award. ahahaaha

      Delete
    2. Serious award and Nigerian flag to thank her specially for her contribution to humanity during this hardtimes. To make we Nigerians laugh no easy o! πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

      Delete
  7. I like the way you wrote today's own. Thanks.

    ReplyDelete
  8. πŸ€£πŸ˜‚πŸ€£πŸ˜‚breeze no blow, fowl carry im own hand open im ysnsh!

    ReplyDelete
  9. πŸ€£πŸ˜‚πŸ˜‚sisi you no go kill person abeg! The woman na bad friend! Shebi she have marry Haba!

    ReplyDelete
  10. Sisi too like amebo but I love you for it 🀣🀣🀣

    ReplyDelete
  11. 🀣🀣 sisi this your gist today ehn !

    ReplyDelete
  12. Your amebo na follow come

    ReplyDelete
  13. Sisi you bad cos you use style know everything

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141