Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, May 30, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Lion In Sheep's Clothing...

Na wah oh!!!








Kpoi! Kpoi! Na who dey house e?


Stellapeperempe...how de horizon? You do well!


Things dey hapun abeg!


Na so we dey yard one evening o! Na so one woman wey get big salon drag one of her apprentice come our side!


Wetin hapun? Wetin hapun? Na small geh! Nor kill am o!


Baba wey be herbalist comot, oga harvest drag the geh go him side. Begin touch wetin I nor know for the geh body!


Landlord no dey house, Papa Ejima ask say wetin hapun? The two of dem no fit talk!

I face the geh, wetin you do your mother wey she carry you come here? Abi na another prodigal pikin dey carry come dash landlord again?!

The matter be say, madam hairdresser dey get plenty customers because she come do 'something' for Herbalist hand.

The apprentice come go open madam drawer to thief money as usual but she see white powder wey she carry rub for face!


Madam wey travel come back from her papa burial, come see say all her customers don port comot, dey begin do home service with the apprentice.

Madam carry matter report give herbalist, he say make he drag the girl come by force by fire. Make he wash wetin dey her face comot, otherwise problem go show madam!

Na as herbalist come out, he see the girl, she kneel down greet Baba. Baba recognise the girl say she be him younger brother pikin.


Fear those old men o, he don smell him blood for the girl body! He say though him and the younger brother never see eye to eye for years, and the wife nor gree relate with herbalist as religious person wey she be! But he know him own amongst crowd, when he see am!


The girl narrate how the madam dey punish dem with no food, no off day plus Sunday, na 10pm dem dey close, do wig braiding till 12midnight etc.


I carry my clothes enter house lock door. I know say na one of two things go happen. Baba nor go gree harm the girl o! The madam go see woto work because na she be customer for there! And for that kain matter, customer nor dey right anything!


I  signal oga harvest Make he comot hand for the geh 'west', make he leave the matter, enter house! I no even know wetin to talk for the matter again!


Na case of man wey think say he carry sheep come give lion for chop, he nor know say na lion pikin wey wear sheep cloth!






Hmmmmm na wah oh... Hair dresser using Jazz? unto what? wont she already have customers who must make their hair o matter what?

12 comments:

  1. Hahahaha. I don't trust people doing hustle because they must put hands for something to make them better. Only those that fears God Almighty and has the fear of God will not put hands on JuJu. They are so many

    Ninja na the more you look, the less you see

    ReplyDelete
    Replies
    1. The more people look d less they see.
      This life eh.

      Delete
  2. Them the always use one or two things,that one na 'dole'.

    ReplyDelete
  3. Na wetin some dey do be this. Na wa!

    I like the parable wey you use for the end.

    ReplyDelete
  4. Hmmmmm this one na obonge

    ReplyDelete
  5. Stella, nwanyi oma hair dressers do jazz much, apprentice go full their shops, customers go full everywhere, there is one in my area, she was caught by women going out early for their biz. Where you do your hair and nail should be very important to you as a Nigerian, even barbers sell hair to people for purposes

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141