Wahala start after the man (name withheld) tell his wife say he dey travel, only for the wife to later receive information after some days say na one banker (name withheld) wey all of them dey stay the same street Naim camp her husband for her house for the same street dey give am better #Hot_Obenikoroja_Style every night.
The housewife come go confront the banker say '"this kind thing no good abeg release my husband'" the banker con truly release Oga and later carry people go Beg the house wife for house to forgive her say she no go ever get anything to do with her husband again but to the surprise of the housewife, she con later discover say the #Obenikoroja business still dey go on with between the banker and her husband, Naim she con begin call the banker for phone dey warn her to leave her husband or else.......
People just dey compound few days ago Naim sidechic show area with police to go arrest her #fuckmate wife Naim all the area women come out say this kind thing no fit happen because na only you dey #doke person husband, na you still dey bring police to arrest owner of husband. Na so area woman "change am" follow police, no be police clear eyes them take run when them see say Area women don call out with different tools like morter pistol, kitchen knife, turny garri and koikoi shoe to burst the head of any police wey try rubbish.
Watin come surprise everybody pass be say the husband dey support the sidechic and preliminary investigation reveal say the support na because say the sidechic dey pay the guy steadily and both of them don dey plan secret marriage .
Abeg who get husband hold your husband well oh because the street is not friendly at all.
By Warri aproko special on facebook
Just imagine the foolish man
ReplyDeleteThe banker sidechic wan kpai abi?
ReplyDelete😂😂😂, I like pidgin ehhh.e dey make Tori or gossip sweet die!
ReplyDeleteAs for the matter up dere,,na God go save some men sha.
It's the hoedesity for me! Like who does that?? Shameless side chick
ReplyDeleteNne na wa o
DeleteHoedasity kawai!!
Can you imagine, What an insulent.
ReplyDeleteI blame the side chick? I no blame the side chick jare, na the horseband wey im prick no dey stay for one place naim I blame. Thank God for the area mamas dem wey no allow the police carry the real owner of the horseband go. I dey pity the banker Sha, if dose area mamas do meeting on top her matter, na pai be dat. Funny read
ReplyDelete�������� area women para well well
ReplyDeleteOmoh,see audacity oh!
E dey unfortunate sey na the reality of some married women be this.
Sidechics be showing wives shege(if you bin be sidechic to married man before you marry, good for you).
Dead marriage. The woman should just leave d man, he ain't worth the headache. What a shame.
ReplyDeleteAs in! If na the woman dey n*ck papa Ochuko for the same street, how the husband go feel? Some men truly useless but juju fit don enter the matter too. Once that banker lady pack commot for that area, e don finish be that. The jobless man go run follow am.
Delete🦅🦅🦅😮😮🦅🦅🦅🦅🦅
ReplyDeletesnatch and vanish, them dey on patrol o
They will come for you o! Dem say dem no fit "snatch" husband. Woman or girl wey wear kayanmata waist beads, use blue eye and all those coded juju dey waka upandan even inside church counselling with Pastor, no be snatching mission she dey? Ndi clearing and forwarding umu nwanyi. Umuaka highway everywhere.
Delete@Amebo
DeleteYou belong? This one you sabi all their waka waka places and offices and equipments? 😮😮😮😮😮😮
14:09 kuku kee me
DeleteHahahahahahahahaha
Some side chicks don chop liver, only them de snatch only them they claim right uptop another person thing hmmmmm
ReplyDeleteThe man na for the wife but the gbola na street property. Thank God say the wife no be the mad type wey dey cut off joystick if she provoke these days.
DeleteNa wa o
ReplyDeleteEven before I read the tori finish,I know say na the man go give im side chick dat kain liver,if not,who born monkey,this world don spoil finish,notin remain..
ReplyDeleteNa wa o
ReplyDeleteNa wa o
ReplyDeleteHow ladies downgrade themselves to be called side chics.
ReplyDeleteA banker for that matter, even spending money on the man ,no bi mumu she bi?
If you were not ready for marriage why did you go and bring another man's daughter to your house?
Useless men everywhere.
Reason a woman should have a means of income,Incase the man start dey misbehave,you give him chance and face your life to avoid this kind of shameless fight.
Women that spend money on men are trying ,unless na my husband.
Nawa o! Imagine the guts of the sidehen.that husband I no understand.
ReplyDeleteI no get Time with Sidechick matter un2 say" The Good You do,lives with,for Ypu And the Bad You do Lives with,For You.
ReplyDeleteIt Might only take Time but Definitely Its comes Round.
If 2 say Sidechick Special, She for don dey Man House/ Evn if Oga marry am,Naaaàaa still 2nd she go forever me.
There is no love there.
DeleteSide chic and Sugar daddy 'ministry' is like trade by barter.
The exchange commodities are s*x and money.
Wentin dey cause am,greedy and long throat.
Women sef. Abeg women make una respect yasef o
ReplyDeleteThat dirty smelly siderat, will receive humiliation in full dose for the rest if his life. Wipe ur tears woman, that wrapper called husband does not deserve you one bit. God will give you a better man or upgrade ur life to conquer ur shame and midnight tears.
ReplyDeletehahahahahaha omoooooo wahala no dey finish abeg... I've got nothing more to say
ReplyDeletewhat is the point in holding onto these kind of marriages? God forbid this kind of disgrace. Please leave him for side chic... Unless its just a battle of wills..
ReplyDeleteFor the 50 years anniversary with an expired and broke man.
DeleteWhen the man no get work wetin you expect. The man need to survive na abi ashewo work na for only women.
ReplyDeleteLovelace
The tori tie bandana abeg. You go fear liver na! You dey dey follow mama Obruche for street dey chop the same gbola. She provoke but she nor even woze u ordinary slap unto say you dey wear coat go work. Only you still seize the gbola wey una two suppose dey manage for area put inside your own haas. As in, you go chop gbola as breakfast, then lock the gbola inside house go work, come back continue to dey chop am from where you stop for morning. So tey Mama Obruche nor even see ordinary boxers and biebie to romance again. Only you still gather kidney call police to come arrest the person wey get original receipt for the gbola! Nor be juju be dat?😱
ReplyDeleteO mehn, I bow for the matterz oh.. Which levelz!🤕🤕
DeleteHahahahahahah abeg make nobody worry d side chic o. Na jeje she dey wey one werey go toast her. Face the man and the wife that went to threaten her first based on where is my horseband.
ReplyDeleteWomen, stop fighting over men that dont regard you. All these ao far he comes home,he can do whatever he likes breeds huge doses of disrespect. But no, nigerian women like marriage more than their happiness. Rubbish.
You are obviously a side chic. Have some shame and get your own man. Don't you feel stupid that they hide you? Wasting your time for nothing!
Delete14 :53
DeleteYou dat is crying daily. Your husband doesnt come home early and always has excuse to leave u and ur kids. Hahahaha becos i dont support doormatism, u call me sidechic. Who are they hiding? Can ur man flaunt u in real parties? Or are u just stuck in d gathering of old family and friends? All ur so called husbands friends know us and if u dont know, we have properties bought in our names by ur so called horsebands who are misrable without us. Na we dey hold ur marriage. How many times u dey baff? Dirty angry bird. Trophy wife, only useful for rearing children dat later wont hear word.
Nigerian men don’t hide their side chicks o. Someone bold enough to arrest the wife?
DeleteWhat a shameless comment from a shameless side chick @17.39. They will continue to use and dump you, since that is the level you've put yourself.
Delete**If 2 say Sidechick Special, She for don dey Man House/ Evn if Oga marry am,Naaaàaa still 2nd she go forever be.
DeleteAnon sidechick, that comment up there is for you.
17.39 ah ah wetin
Delete21:26
Delete21:28
Lmao at use nd dump. Na ur type dem go shit put for her mouth but becos she wants to die with a title she must die der. Pele o veteran doormat. U better find ur value sharp sharp. No be by putting for house o, are u happy? Are u really happy? I hope u dont cry tonight o madam trophy. They continuously use u nd play on ut fragile emotions, the reason ure ranting under anonymous in a frustrated manner. Get joy today o hanty. Make marriage no make u craze.
21:26
Delete21:28
Lmao at use nd dump. Na ur type dem go shit put for her mouth but becos she wants to die with a title she must die der. Pele o veteran doormat. U better find ur value sharp sharp. No be by putting for house o, are u happy? Are u really happy? I hope u dont cry tonight o madam trophy. They continuously use u nd play on ut fragile emotions, the reason ure ranting under anonymous in a frustrated manner. Get joy today o hanty. Make marriage no make u craze.
21:26
Delete21:28
Lmao at use nd dump. Na ur type dem go shit put for her mouth but becos she wants to die with a title she must die der. Pele o veteran doormat. U better find ur value sharp sharp. No be by putting for house o, are u happy? Are u really happy? I hope u dont cry tonight o madam trophy. They continuously use u nd play on ut fragile emotions, the reason ure ranting under anonymous in a frustrated manner. Get joy today o hanty. Make marriage no make u craze.
21:26
Delete21:28
Lmao at use nd dump. Na ur type dem go shit put for her mouth but becos she wants to die with a title she must die der. Pele o veteran doormat. U better find ur value sharp sharp. No be by putting for house o, are u happy? Are u really happy? I hope u dont cry tonight o madam trophy. They continuously use u nd play on ut fragile emotions, the reason ure ranting under anonymous in a frustrated manner. Get joy today o hanty. Make marriage no make u craze.
E pain aunty sidechick so te she post comment 4 times 😂😂😂. If you were of value to a responsible man, he would put you in his house, no? You are here taking crumbs from the table, I shame for you, chai!!!
DeleteIt's obvious you are hurting, thus the anger towards married women. Heya, pele. Go for therapy you hear.
DeleteNa wa o, so side chicks feel this level of misery? O ma se ooo
DeleteKaị!
ReplyDeleteA Banker this shameless??
El oh El!
🤣😂🤣😂🤣😂🤣😂 The area Mamas na the real deal!
Pidgin dey sweet walahai!
Very hilarious narrative.
If the wife must accept between having the said banker as her husband side chick or second wife? Just thinking aloud
ReplyDeleteWahala too, nothing person no go see
ReplyDeleteSome men sha,just imagine the shame
ReplyDeleteAnother angle: is this woman ready to do without the banker's salary? Because this send to be the source of funds for the entire family.
ReplyDelete