E say if him no go treat him knee wey (e take run before) don pafuka,say them fit cut the leg throwey.
Na Maina Lawyer dey beg the Judge for Maina.
Na the second time wey the Lawyer go dey ask for Bail after them recapture Maina from Niger Republic wey he wan pass use run enter America.
Wetin you think about this kind News? Make them release am or not? You dey think say e fit wan run again? Tok your mind ohhhh
Make dem give am bail but he should receive treatment for National Hospital for Abuja, not abroad n
ReplyDeleteOga please nothing dey do you, na scope you dey use for us
ReplyDeleteNa which Kain talk be that? Ok make him bring all the money wey him Tiff first, then we go talk about the bail mata.
ReplyDeleteHmmmm Nigerians ehnnnn
ReplyDeleteMy own be say, make them treat am the way Dem dey treat other criminals. Poor man wey steal 100000, Dem no dey give am bail make e go treat himself. Infact, them fit lock am for jail make e no see court for years. Some dey die for jail for crime wey them no vomit sef. Therefore, I no see reason why Dem go give legit criminal bail.
ReplyDelete