Lagos state government don drop press release say make every student for the state wey dey go school siddon for house until 'fada' notice,until them fit calm down Lagosians wey dey protest say make dem EndSARS and End Police Brutality for Obodo Nigeria...
Dem advice say make the Students dey learn how them dey learn since when Covid 19 lock dem put for house for many months.....
If students stay for house,dem parents nko?Dem go stay too or dem go go work?I dey ask because i dey wonder who go dey look some of these small pikins for house if them papa and mama go still go work?
Na to siddon look remain.
Una Doh Ooooh
Pidgin post go return!
What a year for Nigeria.
ReplyDeleteWhen Freeze dey talk am sey “ ds year go rugged”, some people dey call am craze man. Freeze don turn seer as e prophesy over happen sef. Na wa .
DeleteOur children make una no wory na una future we de fight for.
ReplyDeleteThis matter don dey tie wrapper.
ReplyDeleteNigeria just dey turnioniown.. Make una wait, my question be say wetin happen to Nigeria covid, them no update us again... With d number of protester and notin do us since except for hungry,... Make una tell dem say make dem off mic
ReplyDeleteNa real fada notice. kikiki
ReplyDeleteIf mama and papa go to work,Who will take care of the children tho.Parent out there please protect your children oooo.
ReplyDeleteHow man go do? Make dem commot children for road Tilly matter come down small
ReplyDeleteStella,wetin happen to our dog now. Abi she dey protest too? This goat no happy to replace am o.
ReplyDeleteAbeg this goat naim get swag pass the dog, you nor see am tie wrapper,carry handbag and wear glasses😕 how swag dey reach again?
DeleteBy the way, how you know say the goat nor dey happy? You sabi speak e language???
One of my neighbor works in a public school.. She sef run reach house yesterday ni o due to the protest everywhere, she said parents kept coming one after the other to pick up their children at the early hours of the day.
ReplyDeleteNa wa.
ReplyDeleteIt is well with this country.
Those that have paid Sch fees nko?
My children are excited even me that wakes up early to drop them off!..
ReplyDeleteAbeg make this not pass this week oo..
They have stayed home enough during the Corona lock down...
You see this news got me so angry,to think that my child just resumed yesterday o 🙄😡
ReplyDeleteGood the schools are shut. My whole family is home, hubby worked yesterday and heard nwii on the roads,his firm finally shut down too.
ReplyDeleteThere are lots of things to learn from home and online but for this week they'll be sleeping and playing first.
As I type I'm the only one awake.
Let them rest. This country na wa.
There parents go kukuma sidon 4 house too,bcs only them nor fit takecare of themselves.
ReplyDelete2020 na ogbonge year.things na pasa ka passat!!
ReplyDeletegood ooo as we no won hear story for anything wey go happen to those children
ReplyDeleteTwenytweny, it is well o.
ReplyDeleteThis year no come to smile but with God all things are possible. God, I know you're still in charge.
ReplyDeleteThe school I teach in opened.Live in ilasamaja Lagos state
ReplyDeleteMadam Stella the tin tire person o..me wey dey always go out go hustle how I go do.as Dem pickin dey house na to lock them inside sure pass..I go prepare food for them,bath them lock them Waka go hustle so we go see food chop tomorrow.
ReplyDeleteVery risky..what if there is a fire outbreak?..
DeleteNo amount of money is more important than those children
Please and please, don't lock your kids inside the house. What if there's emergency like fire outbreak, or one of them fall sick. Had I known will never be your portion.
DeleteE good o, e beta make dem dey for haos dan make somtin bad happun to dem for roads.
ReplyDeleteThis 2020 should come and go already!
ReplyDeleteWhat a hell of year
I wish i could uninstall 2020 .