1. Na person wey never see problem dey use good English dey pray.
2. Book wey no gree enter head go enta exam hall
3. Goat wen get mind follow lion go catch fish, make e know say weda dem catch fish or not, Lion food don set o.
4.who naked no dey shuuk hand for pocket...!
5. wetin concern dog wit family planning?..
6.Na determination dey make Okada overtake trailer for road.
7. This one good, this one good na in mad man take dey gather plenty load.
8.Pikin wey go strong go strong.... No be until dem name am Samson.
9.Na over confidence naim make February no complete.
10. Do you know who I am? Do you know who I am?..Naso hold up take dey start.
11.Head wey no wan think go carry load..
12. Them dey hide craze man he dey blow whistle.
13. Forget Trust If trust dey, Water for no boil Fish....
These are Waffy proverbs,do we also have Igbo,Yoruba,Hausa or any other tribe's proverbs?
1.(Naija)Sisi wey stand outside, get persin wey she dey wait for π
ReplyDelete2.Cut suya, cut suya, na for nama bodi
3. The race wey (Naija)sisi tear commot hands for her chest, wetin
dey pursue am dey long π♀️π♀️π♀️
4. (Naija)Sisi wey dey press phone for night nderi, if she no catch usu; bat, she
go catch owl ππ
Crazy hilarious true words.
ReplyDeleteNo be today kwash dey back
DeleteWe don see plenty Christmas, easter no be news
No teeth for rotten mangoes
Abeg abeg I no fit shout
No number 2 correct wella. Dat number 6 na lie, na impatient de cause am. No 13 is everything. Sense dey inside dat yarn well well.
ReplyDeletewhen you do num 2, dem expell you fr school
DeleteHahahahahahahahaha but Dede I no tell you say I do am na
DeleteHahahaha at no 2.
ReplyDelete11 is the real deal mehn
tohtoh water no plenty, but e dey reach prick baff
ReplyDeletePikin wey no fear carry e papa up, e papa blokos go cover his eyes -Igbo
DeletePikin wey no fear carry e papa up, e papa blokos go cover his eyes -Igbo
DeleteThis reminds me so much of Pararanπ€£π€£π€£π€£π€£π€£π€£
ReplyDeletethis are funny and deep...was it olori that posted in IHN yesterday?
ReplyDeleteWaoh! Educative, lesson proffered yet funny..
ReplyDeletechoke me zaddy, choke me zaddy na im pussy take dey wide
ReplyDeleteHehehehehe
DeleteEhn?
DeleteNa wa
E go come down, e go come down na I'm butterfly take enter Bush.
ReplyDeleteIf you no pull meat, pepper no go enter eye
If nyash shake, waka don start be that
Persin wey get big scrotum say e no pain am, neighbour say I'm no fit sleep because of the scrotum.
Choi, I try o.
carve my hair lining well, na im head dey take wear V-neck
ReplyDeleteNor be by big dick them take Dey born twins
ReplyDeleteTortoise know say house rent cost too much, na e make am carry e own house come life
Difference dey between bathroom and baffroom. If ur soap fall for baffroom, u nor dey pick am againπ
Pikin when Dey find party rice not suppose to fear dance oo
Goat know say the waka waka wey dey dis life plenty well well, na e make am wear shoes come life
Who dey sell pepper no dey use hand dey scratch pri*k
Just felt like jumping on this from the ones I know from way backπ
Hehehehehe @your first line
DeleteIsaaaaaaccc!! ! ππππ€£π€£π
DeleteIf e scratch am
DeleteNa die be DAT o
No 2 correct pass πΆ
ReplyDeleteWetin concern bicycle with fuel station. Them dey use mouth put fish for pot π π π
ReplyDeleteWetin concern bicycle with fuel station. Them dey use mouth put fish for pot π π π. Person wey wear white no dey near red oil. Elder wey say make children no eat rat, make him no use teeth share am give.
ReplyDeleteAkara and moin moin get the same parent, na wetin dey pass tru make dem diffrent
ReplyDeleteNah area Warri boys take dey gather.
ReplyDeleteNah yansh Warri girls dey use break karnel.
Pikin wey dem use Warri or Sapele water baff dey sabi, as in dem be "sabi sabi"
ReplyDeleteFor University days, so this my Lagos friend dey friend one Benin guy, the girl come dey try blend into the Pidgin level, sotey she come dey use past tense dey speak Pidgin.
The thing can vex the guy ehen.
Naim my friend come ask me with vexation one day, if pidgin English no get past tense, say her guy say make she come ask me, from day l begin dey teach am, how to blend.
No be today yansh get center parting.
ReplyDeleteNa woman wen neva see problem dey hold breasts dey run..
Dey nor dey tell deaf and dumb say market don close ...
Fish when nor eat worm for hook well, go enter pot..
Fall for me, I fall for you na dog play take dey sweet..
Na the same teeth when lion take dey carry him picking Na he take dey kill animal..
Fine girl, fine girl naim ashawo work take dey start...
Ashawo wen nor get sweet mouth na hungry go beat am..
Na sweet mouth dem dey take sell rotten fish..
Na for morning dem dey take sell fresh fish...
Na hand dem take drive mosquito wen perch for bloggous...
No 13 is deep..funny proverb, I was just smilling all through.
ReplyDeleteNa from play play clap Dey turn to dance.
ReplyDeleteDem no Dey tell old woman to close leg because you nor no where she from Dey collect breeze.
Different type of ventilation
DeleteAll manner of breeze dey
Any cough wey no comot from mouth
DeleteNa another tin e don be
Wetin concern fowl with toothbrush
ReplyDeleteWetin concern vulture with barber
Na from clap dance dey take start
To craze nor dey hard na the trekking be wahala
Madman sef won barb hair na chance nor dey
Chai
Delete