Stella Dimoko Korkus.com: Mama Tee Series -The Messer (Pidgin Post Alert)

Pages

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, June 08, 2018

Mama Tee Series -The Messer (Pidgin Post Alert)

Na for pidgin we go nack today own, if you no sabi pidgin, abeg fain person make he interprete for you.





The Saturday before the Saturday wen waka pass, fasting never begin that time. I follow some mama mama them for my area go one party for Badagry. 

Dem carry dat blue BRT bus wen get A/C come say make e move us go there.
I dress finish, con give one make-up artist #500 make she do make-up for me, all of una go sabi that make-up wen dem dey call "I wan comot", that first one wen dey for their price list. kikikikikikiki. I con nack koi-koi shoes and better perfume put.

Make we go back to the koko.

The other mamas dem con gather, we con line up dey enter inside bus one by one. My country people, as we tanda for line na so one kain dangerous smell nack my nose oh.

Make I tell una how the smell be. If fowl just born pikins, the remaining egg wen no obey, if something break am, una sabi the smell? Rotten egg. Na so this thing dey smell.

This endtime mess scatter the line, everybody con cover nose dey run. The woman wen dey carry us go the party con dey beg say make the messer of that mess go back to her house if she know say the mess still remain for her yansh. Hahahahhahaha

She kneel down dey beg oh, she say if the person mess that kain mess inside BRT bus, she go disgrace am.
Nobody gree go back oh. Everybody just do face kpakam.

I kukuma fain one seat wen near window put my yansh. If I smell anything I go open the window carry my nose put for outside make person no con kee me.

When we reach Mile 2, I don begin dey doze. Na so that messer discharge another nuclear weapon, chai Chineke meee! the smell vanish my sleep sharp sharp . Everywhere con scatter.

Oga pilot rush park the bus, he say make everybody come down. Na so we open all the windows con rush come down. Wen e reach like 10minutes, dem say make we enter inside again. As we enter siddon, the party woman com dey go round, she con dey tell people make dem stand up, she con put nose for their yansh dey smell am. She talk say she wan catch the messer. Lmao.


All of us support the level oh, the messer no try at all. We must to catch am.
As she reach one woman seat, she no gree stand up. Come see as this woman fat, sorry na curvy I been wan talk, she just balance for the seat like cow shit. Them con ask her whether na she dey mess. She say na she, make we no vex.


 Come see how we provoke dey insult her. She sef con provoke dey insult the party woman say "How you go dey smell person yansh? Na pikins we be for here? I senior you well well, person no fit mess again? Mess no get house, e no dey kill person, na poison?"

My country people, make una con see commotion! Even driver sef follow buy the matter.
Last last, Mrs Messer con vex go down.

My people Na so this matter take shele oh, the mess remove my perfume sef, the thing con dey smell one kain smell for my body. I no know say mess get power like this. Anyway, thank Baba God say we go there, return back to we area without no accident.

Hope say una enjoy my pidgin small, e don tey wen I write for pidgin, make una pardon any gbagaun.


Mama Tee


*Mess remove perfume?hahahahahahaha na fake perfume be that nah...better advice the messer go find who go can the mess use do rat poison...hehehehehehehhhe

48 comments:

  1. 😂😂😢😂 na that kain mess dem deh call mess of life

    ReplyDelete
    Replies
    1. Lols
      This is hilarious
      Kudos Mama tee

      Delete
    2. Very funny write-up
      Mama tee This your pidgin can enter wazobia Fm and other pidgin stations. Have you tried working part time for them?

      Delete
    3. Mummy J, I like to work with any of them but I don't know how to go about it.
      (switches to pidgin) I no sabi how I wan take enter as I no know anybody for there.
      Any bv wey know make e helep me abeg.

      Delete
    4. Mummy J shift your bumbum make I siddon with you. Me too. Even BBC Pidgin I dey eye sef. But I never one dey hear say dem dey recruit. May be their own staff dey fall from pidgin Heaven.

      Delete
  2. Mama Tee you no go kill person with laugh. Person no fit mess in peace? Why the party woman go dry smell their yanch. Kwakwakwakwakwa.

    ReplyDelete
  3. If you no sabi pidgen English hide your face.
    Big people mess can smell no jokes. Don't know why.

    ReplyDelete
    Replies
    1. My dear, not only big people o, my mess fit kill elephant, if only we fit do messing competition for this blog nah, I sure say na me go win am😅😅😅

      Delete
    2. kidjo ewo oh lol.
      Fine girl like you de mess? 😂😂

      Delete
    3. Hahahahahahaha @Kidjo, your own make me weak.

      Delete
    4. EkaTre, Forget all the packaging and unnecessary forming,na fine girls mess pass o, people go dey suspect others but nobody go suspect say na miss fine girl mess am😅😅😅😅

      CutestPat, you weak? Nor worry jst gimme your address, you go strong after you perceive my mess😆😆😆

      Delete
    5. Lols Kidjo you suppose go take agbo jedi, na jedi jedi dey worry you. Your belle don spoil finish. Kikikikiki

      Delete
    6. I'm learning this sweet lingo, pidgin sweet well well and I took time to read everything. I'm deadddddddd the messer ddnt try at all

      Delete
    7. Mama Tee,na the food combination wey I dey eat naim cause am o. I eat indomie, eat and beans almost everyday😁😁😁

      Delete
  4. Hehehehehe, e be like the kind mess I dey like mess in the midst of my frds😆😆😆 everybody go just stand up,cover nose and run once I discharge the mess😅😅

    ReplyDelete
    Replies
    1. Hahahha as you fine like this.

      Delete
    2. Chika Vincent, fine girl na human being na😅 mess nor get toilet and I like to dey do bad with mess well well😆😆I fit pretend to wan shake ur hand, next thing na to turn my bumbum mess put😅😅😅

      Delete
  5. Na this kind mess i dey use dey finish my hubby and my new born baby wetin person go do na since na tea everytime milk and milo cos of breastmilk lols

    ReplyDelete
    Replies
    1. Hahahhaha u is wicked

      Delete
    2. hahahahahaha your baby don suffer for your hand.

      Delete
  6. I don take cover sharp sharp make the mess no con kill me.

    ReplyDelete
  7. Mess no get toilet Abeg.Oga don leave bed for me. I don dey mess plenty. Beller hormones no be here. Good thing is the mess no dey smell

    ReplyDelete
  8. Kai! That kind mess dey very annoying sha. You go almost want die because breathing go dey very difficult. That's why e good make person use the loo in the morning to avoid any form of embarrassment.

    ReplyDelete
  9. That woman is suffering from Coeliac disease.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Coeliac disease
      Make I run go visit Google

      Delete
  10. Kai wat an embarrassment. Thank God she came down oo. She for go toilet in d morning Na.

    ReplyDelete
  11. hahahahahahhahhahahahh. Na WA for Dat Kai mess

    ReplyDelete
  12. Hahahahahahahahahahaha @ balance for seat like cow shit
    Mama tee you are a good writer. Both your pidgin and queen's English are on point.

    ReplyDelete
    Replies
    1. I agree. I love and enjoy all the write ups.

      Delete
  13. Hahhaahh....but the party woman no try at all.. How she go dey smell una bombom

    ReplyDelete
    Replies
    1. Ehen, as Iya no wan behave and own up to her mess nko? Let them treat her like a child. If she had owned up initially, would they have killed her. You mean to tell me that those standing near did not know she released that rotten smell? I detest people who have the manners of jungle animals. Since you know you are releasing smell of dead bodies, kindly excuse yourself and go and release somewhere and then come back. Someone like this load of 'cow shit' will just be releasing smelling bombs with joy in the midst of people eating. Beast!

      Delete
    2. Hahahahahaha anon 14:04 don vex

      Delete
  14. This kind mess carry weight o, sotey e pursue everybody come commot perfume for ya body lol

    ReplyDelete
  15. The Saturday before the Saturday wen waka pass...
    hehehehehe
    Mama tee this your post na real pidgin post. Lmao. It's as if I'm listening to Nedu on Wazobia station

    ReplyDelete
    Replies
    1. Lols
      Abeg make una tell Nedu and Yaw say I be their no 1 fan, make them helep my ministry

      Delete
  16. Mess + Passenger = Messenger
    Na dis kain mess dey cause Global warming. E dey rise hang for air, come form cloud...

    ReplyDelete
  17. Wickedt messer! Na by force to go the party? She never recover finish from the "merix" wey she chop before, she still wan carry her two left nyansh go remix for badagry. Na her mess for scatter that party. Na so one man sneeze near me yesterday! Chai!! Atmosphere change like say eclipse wan happen. I no con understand my Versace Bright crystals again. Thank God for una life o.

    ReplyDelete
  18. Women and party, when she know say na mess be her job description for that day,why she no stay for her house, i am just imagining her extra large body and bom bom inside her iro and buba.

    ReplyDelete
  19. messer of life..those kinda people do poo often, but the day they do na shakabula..lmao

    ReplyDelete
    Replies
    1. That is why they are always stinking up the place na. Someone that will visit toilet once a week or once in 2 or 3 weeks. Is it not refuse bin they have turned their body into? If you don't empty your bin in just one day, imagine how it smells. When they fart, come and smell deadrats smell. To shit nko? Wahala, they will complain that it is like iron nails forcing it's way out.

      Delete
  20. Reminds me of one day in the bedroom that I released one. Poor hubby that was asleep jumped up! He thought it was gun shot! I can't stop laughing each time I remember the incident!

    ReplyDelete
  21. Wow pidgin post. I love this. This poster is so talented and creative. Keep it up.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141